SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. 08/04/14. This na wake up - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. 08/04/14. This na wake up call to all Office holders and the presence of Sapele Tafia suppose instigate orderliness but since some persons nor want peace,we go show dem say na our right to get peace and we go do anything to get am. Gone are those days when we dey see truth dey cover am. If we all join hands today stand against oppression,make we know say na our children future we dey fight about. Last week here for ICE Polytecnic wey dey affiliated to Delta State Poly gada body write exam and i sidon for the middle of the field witness the outcome of the entire exam. Dear Sapele and Delta Stata people. Delta State ministry of education wey suppose cum from Asaba cum supervise and conduct the exam for the students wey dey the center just cum nai dem go meet Mr Ogona wey be the Zonal Cordination/Head for the School. This useless Ogona weda na bribe he give the State people wey cum from Asaba i nor know but as the people just waka round small,nai dem order say make students nor pay the initial N500 wey dem task all d students to pay before dem enter Exam hall. My people e nor tey as d Asaba people go finish nai dis useless Ogona begin drive all d students out from the Exam hall as e begin collect the N500 from each of the students and na everybody nai pay the money. Na where i sidon i still sidon as i dey imagine the wickedness of some of us,and i dey wonder how e go be if dis kain person na Governor. When the exams come start i cum dey wonder why some people dey outside as i patiently wait to see the end. Dis Mr Ogona cum just dey harsh like Dog wey born new over nothing. Not knowing say e dey vex for pipo wey dey inside the halls dey write deir exams, due to say the pipo wey dey outside na special candidates wey don pay N3,000 each to Mr Ogona so dat dem go get access go outside the hall and from the School field to go write deir exam for any where of deir choice to submit wen others dey submit. When i calculate d numbers of students wey go outside go write dis exam,dem reach 67. If we multiply dat number by the 3k nai be N201,000 wey dis bastard carry go House outside the N500 wey e collect generally from all the students. Why we dey use our hand dey spoil our future and we go still dey expect better tin from God. Dis Mr Ogona so na pastor for one church but make unu see as e allow money dey rule am to the detriment of our children future. I nor wan talk much dis morning becos i dey very busy with my Girl issue wey break her spinal cord as we dey carry her dis morning dey go UBTH from the N185,000 wey we don gada so far as i dey press for more so that the Operation go take place dis week. I dey use dis update dey call on Delta State Educational Body from Asaba to call dis Mr Ogona to order and direct am to refund the N500 each wey he collect from all the students hand. Also make the State body nor dey send pipo wey dey conspire dey wicked d students as dem dey collect bribe not to supervise deir exams.Mr Ogona wey claim to be Pastor nai open eyes steal from students then on sunday e go dress wear big native with big bible say e dey go church. I wonder d kain eyes wey God go take dey look dis kind person from above. Mr Ogona good name better pass riches. Success of today na from the hard work of yesterday. If u nor fit allow the students to competatively display deir knowledge how we go take get the success of our tomorrow? I don dey observe you since as some persons for dis town wey dey ur School nor dey cum school at all but u dey throway scores give dem due to the plenty money wey u dey collect from dem,after u don promise dem heaven and earth. As a matter of fact you write exams for like 6 people wey nor cum School at all and na only God know amuch u collect from those special candidates hand. I don dey warn you dey come since but you dey feel say ur heart na iron. If dis silly thing happen again for dat school nai be say na ur sack letter go welcome you the following week and i go make sure say u get am becos Education na our only tool to wake up the minds of our future leaders. So we nor go tolerate any tin wey go put our children under bad Governance. Make i run go see EFETOBOR JULIET AFINOTAN as she dey go UBTH now for thorough body examination,X-ray and the spinal cord operation under our expenses from dis forum,after Hon. Julius Egbedi promise and e fail yakata. Make dem go with the cash wey dey wit dem first,den wen dem don bill dem wit assurance say dem fit do am we go cum know amuch we need to raise to cover the entire bill. Na me the Otota1 of Sapele. The Urhukpe1 of Okpe Kingdom. The Asamaigor1 of Itsekiri Kingdom. The Eagle Eyes Of Delta State. God Bless Sapele. OGONA SUPPOSE REFUND THAT MONEY OR NOT? SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Tue, 08 Apr 2014 05:42:48 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015