SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER 14/11/2014 AMEN No matter - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER 14/11/2014 AMEN No matter how sun hot reach, e nor dey dry clothes take. When dem call my line, break the news give me say my best friend wife die during child birth, na so water just dey pour from my eyes like who dey cut onions for sun. Without wasting time, I enter my car, drive go e place. When I finally park near one toyota Tundra, as I come down. I first feel say dem dey do marriage for the area. Cars many like say na Catholic church harvest. When I enter the compound wey my friend dey stay, I see pipo full e gate. Shoes and slippers full everywhere. Na so I just waka go one corner close my eyes pray: Baba God, pipo nor go park motor for my compound and pull slippers for my gate to come tell Me sorry. Make you continue to protect us. Amen. When I finally enter the over crowded house, na so I continue my cry as I jam my Padi sidon for rug dey cry. I enter the house around 7 for morning.. I meet more than 50 pipo for the house. One by one, na so all of dem dey go. Some dey come, some dey go by the hour. When time don reach about 10 for night, I cum tell my padi say I dey go o. Na me be the last person wey comot from the house. When I dey wear my shoes for outside, na so conscience cum dey judge me. Say I supppose stay with am. How I go allow am sleep the house alone. But as I dey battle with my conscience, I cum realise say my wife travel go Cotonuo. So, I need to stay with the pikins dem. When I reach house nai I just dey reason this life base on when bad thing like this happen to you. My pipo, when you lost somebody to death, no matter how close your friends dey to you, e get where and when dem go stay with you, dem go go their way. And leave you to be alone with your sorrow and tears. No matter how you love someone, there is always a point when you go turn your back and walk back home. LET US PRAY Dear Lord, anytime pipo wan gather for my house, make e be for happiness and celebration. Na canopy of joy I go set for my family compound this year and always. Amen. If death wan come, baba, let am come at the right time. We nor wan print poster with a tag We regret to announce! Gone too soon. Untimely death. Great loss. Baba, na celebration of life. Call to rest. We thank God for a life well spent. Glorious exit. Nai we wan print. Amen. And above all, When sorrow strikes, console us with your love and hope in glory. Amen. In everything, know say in times of sorrow, friends must leave you alone to cry. But the consoling words wey dem give you, recall dem and let dem keep you strong. Nor wallow in your sorrows. Remember, God giveth and e taketh. To those of us wey don lose loved ones, may God give us the fortitude to bear the lose. Amen. God Bless Sapele. I LOVE SAPELE. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER
Posted on: Fri, 14 Nov 2014 14:55:18 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015