SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. 16/12/2014. Hon. Ejaife - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. 16/12/2014. Hon. Ejaife Odebala. Before i go talk anything dis morning,make i first thank God for all unu wen dey dis forum becos dis remaining part of the year need extra Thanksgiving to God,becos e nor easy. As Sapele dey now,na you Hon. Ejaife Odebala nai the Council see as the Papa and all workers/citizens of Sapele see you as deir Papa. When Christmas period dey reach like this e dey very common say Papa,dey take good care of the children,becos e go want make the best of the pikin come out. Na dis kind thing nai dey make mama Papa,for d first time dey go Market sometimes with the children or e go send mama go. After dem don go the Market,buy the things wey the Children go wear,for the Christmas,you go come notice say,for the House message nor dey land before the children dey go. This thing dey make family dey sweet. Hon. Ejaife Odebala you be the Papa for Sapele and if them say make you feed or carry all of us go Market go buy we things for Market,Local Government Council money go finish and one Political WARD nor go even dey satisfy. Though as you dey expect Rice to share,nor forget say our Studio dey and we need Rice for the Less Privilege ones wey your hands nor go fit reach. So to buy we the Safarians Christmas gift,i dey call on you to helep us,patch most of the Pot Holes wey dey the Local Government. The reason wey make me pick this Holes as our Xmas Gift,na becos dis period Sapele go get visitors and many foreigners go come with our Children wey go Abroad to come spend the Holiday Season. I thank God say you na person wey dey Travel well well and you dey see as other States,Countries and even some Government dey celebrate with the masses. I go also like make you talk put for this light matter,becos people wen cum for Holiday nor go find am easy,wen we go dey welcome dem with Darkness. Most of the Pot Holes wey i dey talk about na small small Holes but where dem dey don dey cause accident. E.g The one wey dey Yoruba Road before Akintola Road. The one wey dey near ABC Chemist for Gana Road. The one wey dey Adeola Road by Rainoil. The once wey dey Palm Avenue,Boyo Rd by Market,Yoruba Rd by Hausa Road,Ogodo Road,Macpherson and Levi area. etc. I know say you go try pass every other Chairman wen Sapele don produce becos for you to get heart among Okpe people,bold print paper say,you wan contest Governorship,i know say something dey ur coconut. Na better advice i give you so and i go call you later in the day,to hear your version. But i just get to hold the town hand take make dis appeal,becos na water wey touch Yanch nai dey touch Brukus. I Remain The Otota1 Of Sapele. The Urhukpe1 Of Okpe Kingdom. The Asamaigor1 Of Itsekiri Kingdom. The Eagle Eyes Of Delta State. God Bless Sapele. My people,hope i dey line? SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Tue, 16 Dec 2014 07:35:27 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015