SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. 20/06/2014. Dear Elders Of - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. 20/06/2014. Dear Elders Of Sapele Houses. I know say unu sleep well but i nor get much to write dis morning than to first tell God THANK U SAY U WAKE US UP WITH GOOD HEALTH. Now make all unu stand make i throway my yarnis for ground make e nor be like say i nor talk now when d matter fresh. We agree say dem nor dey buy sense for and me nor even get d one wey i wan sell not to talk of to dash anybody. We from dis forum go testify say the issue of CULTISM don almost make we from dis forum die with Local Government office chairman due to d way Army dey catch and dey kill dem without due process. I dey with some friends yesterday for Reclamation Rd wen some small Boys dey yarn how dem dey roll for nite dey collect people fones and dey find deir rivals for Cufra issue. I nor yarn becos dem be like Ant,14,15,16,17,18 & 19Years nai dem be. My dear Sapele people na Ikomi Rd by Mcpherson nai i tanda put dey find bike wen another set of small Boys for dey yarn say na 6Phones nai dem collect from people hand d previous day wey cult groups dey fight and wen i imagin deir mates dem be like 16yrs of age. I cum dey escort dem dey listen wetin dem dey gist. Wen dem see fine Girls dem go admire d Girl den continue deir yarnis,but dem come talk say dem nor even dey any of d cufra but deir job na to dey roll dey do free looting of phones and money. One cum say na to dey rape Girls nai him like say but dier leader nor dey want such things. Dem nor dey follow breeze dey fight. Dis children wey dey SPIROL AND JVC na our smallies dem for House,Area and Streets. With d way wen dis children dey go so e good? NO I go dey very disappointed if dis fight between JVC and SPIROL escalate pass where e dey so,becos if Army take charge i nor go talk put oh and we know d meaning of Army for dis kain matter. As i dey talk to unu now dis boys continue deir display for d town yesterday and dem tie deir faces with different tools for deir hand. Na from our Houses nai dis small Children from dey go out go do all dis things so make we by now caution dem and stop dis yeye menace wey go result to killings. Them nor even know deirselves finish if dem dey waka. Na so i join dem waka almost 4 Poles as i tie my mouth too,fly my buttons cum hold long wood. Na for deir mist i for almost here all deir names,as dem just dey secretly dey mention deir names. Make unu nor dare me becos i go paste all deir names here if dis tin pass as e dey so. Unu go dey fight dey let all dis Politicians dey make more money for our head,say na Security volt. Make unu get sense oh becos i dey vex badaly dis morning. I don dey call some Oga make dem norva let out Army to handle dis issue becos of the current tense wey demolition put for people body. Na wen mango ripe e dey fall,so make we handle dis issue from our corner today before the Government go take over. Drop ur comment now on how we fit take address dis issue so dat we nor go lost close friends,children and relatives for dis umukurubu cult groups. Na Me The Otota1 Of Sapele. The Urhukpe1 Of Okpe Kingdom. The Asamaigor1 Of Itsekiri Kingdom. The Eagle Eyes Of Delta State. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Fri, 20 Jun 2014 07:05:04 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015