SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. 27/10/2014 MAMA - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. 27/10/2014 MAMA JENNIFER Mama Jennifer born three children for her sailor husband. Dem dey stay top for one storey building for Sapele. Anytime the husband go sea, she go dey doke their neighbour, Femi wey be bachelor wey dey stay bottom of the upstair. One time when the husband come, one other tenant cum tell am say e dey suspect e wife with the guy. This thing cause serious wahala for the compound that week befor the husband cum go back. That first week, mama Jennifer couple. The second week of her husband travelling nai she cum start to dey go doke this guy again. Wetin don enter person blood, e dey hard to comot am. This fateful night, NEPA seize light. She don baff and feed her children. She cum do dem make dem sleep. Befor 8 O clock, all of dem don dey sleep. Mama Jennifer go kitchen, serve food for cooler, cum off the candle, lock the parlour door. Na so she carry key inside her husband shirt pocket cos na her hussy shirt she wear that night. Na so she take climb down go meet her guy who don dey room dey wait her since. As usual, she lock the guy sitting room door for inside. She cum carry the food wey she cook go give am for room. Rechargeable light dey on for the room even the parlour. The guy end the gbagba akra and hot eba finish nai show start. She cum pull her skirts, naked, nai she climb bed. As dem dey commit dey go, nai be light wey NEPA bring. Small time nai pipo begin shout for the compound. Fire o! Fire o!! Fire o!!! When NEPA bring light, wire spark for inside mama Jennifer house. Fire cum start to burn. Smoke don full everywhere. The three children nor dey see. The senior one manage reach the door, but the door dey locked. Compound pipo dey shout. The fire don dey spread enter the next flat for top. When dem dey shout fire fire, na so mama Jennifer jump from the guy bed. Everybody for the compound see her when she dey come out from the guy house. Befor she finally open her house door, the three children don roast like goat for the fire. Na so she take faint wey dem take carry her go hospital. This na marriage of 15 years o. Dem don wire message to the husband now say see wetin happen. The husband dey ask now Wetin unu advice am to do. And my pipo, wetin unu advice the woman to do befor her hussy come? See, if you as a woman get any reason why you must cheat on your husband or straff another man, I advice make you divorce your husband first befor you go dey sleep with your man friend which is even bad. Make I go sidon near papa Jennifer to console am. God Bless Sapele. I LOVE SAPELE. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Mon, 27 Oct 2014 13:11:50 +0000

© 2015