SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. 30/05/2014. Hon. Julius - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. 30/05/2014. Hon. Julius Egbedi Clap For Yourselve. Dis thing wen i wan talk about now so na wetin i don dey see since but i choose to quiet becos i really wan see howfar the thing go reach. We all know say State Government approve POVERTY ALLEVIATION PROGRAMME to helep some of our unskilled mothers wey dey within the State to get small job,just to dey helep the Government dey sweep most of our major Roads within the state and to also dey clear off the dirty wen dem sweep out. Dis programme for a long time cum dey sleep and i dey very happy say dis Government cum sidon look d issue well again to wake am up from slumber. With dis initiative i cum see say most of our widows and old women wey dey leave on pennuries don dey manage dey wake up again to carter for deir families. I throway special salute to our State Government and Hon. Julius Egbedi wey play along to dis empowerment programme. Becos if dem wan sink the money like SURE-P own dem for still do am but God know say na d best thing nai dem do so to assist dis large number of women wey dey helep sweep our Roads. Some persons dey ask weda na dis issue be our State problem? I quiet d day becos we dey Uduaghan Bus dat early morning dey go Koko main town when some group of women dey gap mouth pa-pa-pa becos dem nor know the level of unemployment wey dis thing eradicate from the women wing. If we look the Roads dem well we go see say san- san don almost dey cover the roads and the thing dey cos retarding of vehicle according to oyibo and e cum dey weaken the coation of the tarred road,as some vehicles with speed during emergency brake dey get problem becos d small san-san so fit swab the vehicles wrongly and dat dey contribute to accident. Also our major roads wey Government spend big money repair nor cum dey fine for eyes again,as san-san and lilons wey most of us dey throway pass windows dey pollute the roads and disqualify the beauty of the roads. We go agree say,as we dey throway dirty pass window from cars and vehicles we norva for one day say make we cum down or waka go sweep Government Road or clear the dirts wey dey the road. Government cum also see say na Raining season naibwe dey so and if dem nor handle d season well,most of dis san-san and lilons wey we dey throway so fit contribute block the drainage,so dat na why dis initiative wake up again from d sleeping floor. I know say our Government still get flaws for dis excercise oh,but make we d masses helep ourselves and stop to dey contribute to environmental hazard becos na we go later dey suffer am. Some of us wey dey sell along dis major roads we nor get dust bin for waste products,becos i dey see most of us dey sweep our store fronts dey enter gutter wen dey our front. Also after we don hip dirty for our Houses and stores,wen we just see say heavy rain dey fall,na dat time nai most of us go carry all our dirty go pour inside errosion,make water helep us throway dirty. My people all dis thing wen we dey do na ourselves we dey do nor be Government. Becos wen d drainages go block na our compounds nai d water go flow enter and if God wan rili punish us,e go cum flow enter our Houses and maybe na dat day nai we nor go dey House,so dat e go real spoil our Electronics and valuables. If we nor dey do am and our neighbours dey do am and we dey keep quiet nai be say dat na evil act too. For dat case e go good make we report such issue to Local Government Offices wey dey incharge of dis issue or match go Chairman office directly,dis na if you don advice d person and e nor gree stop oh or e cum promise to give you fight after ur advice to her. Hon. Julius Egbedi you nor see say with constructive criticism you don dey wake up well,as you don finally dey checkmate most of d tins wen we discuss earlier. But even as i dey praise you so,u still get some areas for dis issue wey u dey slow put. AFter dis women don suffer sweep d roads well. We nor dey quick see Vehicles or Tippers wey dey come pack d san-san and wen small rain or breeze just cum e dey blow most of dem dey enter the Gutter well. So i go advice you make you helep dey monitor d Tippers so dat dem nor go dey slow again and dem go dey quick dey pack d dirties and san-san wey dis women dey sweep out. Also i cum still notice say we norva get people wey dey sweep the Okoloko Bridge side and e good make our entrence fine for eyes and make d san-san wey dey d bridge nor contribute more weight to dat bridge becos dat Hon. Henry Ofa slab na rubbish. My people we know say other issues dey ground oh,but wen dem carry somethings give pikin go hawk,if e hawk am finish dem dey tell am THANK YOU make e for do well tomorrow or next time. From Studio we throway special SALUTE give Hon. Julius Egbedi as e do dis great task and also clear d dirty wey dey New Rd wen we draw e attention to recently and also dey attack all those pipo wey dey pack and stock sharp san for our roads as dem dey block the flow of our Roads. God go do am for you EGBEDI. I remain the Otota1 of Sapele. The Urhukpe1 of Okpe Kingdom. The Asamaigor1 of Itsekiri Kingdom. The Eagle Eyes of Delta State. Our Roads for Sapele don dey fine well well now. Make we hail Hon. Julius Egbedi for e good work. GOD BLESS SAPELE. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Fri, 30 May 2014 06:26:04 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015