SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER BRING BACK OUR GIRLS E dey so - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER BRING BACK OUR GIRLS E dey so painful and shameful say becos of one reason or the other, some pipo wey dem call demselves Boko Haram go dey do things to destroy our father Land. Dem say dem dey fight e religious course. Make women nor embrace Western Education. Dem wan turn a whole nation to one religion. Anybody wey nor dey practice their religion, na pagan or enemy and e fit to die. Na this mentality dey make dem dey kill and destroy. Any religion wey nor dey preach love nor be for human being. If dem don kill everybody finish, who dem wan preach to. Dem dey carry bomb dey throw anyhow like children wey dey throw knockout during christmas period. Dem dey cause unease and unrest for the country like children wey ashewo born for thief. And now, dem don graduate into kidnapping. Children wey go school go learn how to read and write, nai dem kidnap for how many days now? E dey so painful say this Boko Haram pipo na Nigerians. Dem born dem for this country and them know wetin dey sup. If unu dey claim say federal government dey marginalise unu region for the country, na so unu go take get results? No! When person get issues with another person, the best way to resolve am na to dialogue with the person. And in some cases, this dialogue fit nor go your favour. But becos say no region, no tribe, no religion or no culture big pass the full country, we suppose accept federal government resolution with good fate. Boko Haram. This bombing need to stop. This killing nor show the good side of wetin unu dey crave for. This country big pass one sect agitation for anything. Whether unu kidnap all the girls wey dey this country, Whether unu bomb all the public places in this nation, Unu nor go fit defeat Nigeria. God don already establish this country. Biafra, Militant nor reach, na unu wan fit? Make unu think. Think and reason like human beings. This pipo wey unu dey destroy their property and kill and kidnap so, na unu own pipo. Pipo wey fight and struggle nor concern nai unu dey displace and destroy. Kill and maim. Kidnap and disorganised. Why? Unu nor know Aso Rock address? Please, this fight nor concern the poor. Go National Assembly go show muscle. Make unu release our girls. Bring back our girls. Too bad for those of us wey dey hide sponsor this evil, and those of us wey dey carry out this evil, make unu withdraw from this evil. Go beg God to wash your sins away. And for the girls wey unu kidnap, make unu release them back to us. Many tears don soak the nation, Many hearts don break since dem hold all these girls hostage. Bring back our girls. Make unu bring back our girls. All fans of Sapele Tafia, home and abroad, make we close our eyes to pray. Dear Father, Our girls wey Boko Haram kidnap, We pray make you cause confusion for the boko Haram camp so that dem go release our girls for us in Jesus Name. Amen! God Bless Sapele. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Sat, 10 May 2014 13:46:27 +0000

© 2015