SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. Dear Niherians Worldwide. I - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. Dear Niherians Worldwide. I personally nor wan talk for dis matter before becos e dey very obvious say even the interational world done see the high level of unemployment wen dey Nigeria with, the statistical representation of high level of turn out within all the states on the application of the federal immigration exam/ application. Just last year nai the head of Immigration openly announce say them get space to occupy and with that dem need Nigerians to apply for the job space. First I fault the application method wey require Ssce, Ond, Hnd, and Bsc graduates within Nigeria to pay N1000 each to register for dis exam. If we record dis small amount of N1k from each of dis applicants we go get Millions of Naira. Now our question to dat effect na wetin Federal Govt wan use dat money take do? Why taxing jobless Nigeria for job slot wey nor dey certain. Many of dis people find am very difficult to eat daily, some nor even get enough money to photocopy deir entire credentials since dem graduate just becos no means to survive. After one year of applying for d job, the head of Immigration open postponed d exam, say them need to look for a suitable method to write d exam, becos the number of people wey apply shock them. Dear Nigerians after one year of wait. The best dis people fit do na to invite our children to open places, such as Stadiums, Event and Civic Halls within the Nation to write Exam wey dem agree say dem don ready to conduct. After the long wait of joblessness. After the the much efforts by dis same people wey vote Politicians into Office. After the long endurance. All wetin we see na death trap method to screen our children for exam wey dem don already distribute give deir loyalist within the states. How possible e dey for dis pipo to conduct exam for a particular spot for more dan 12,000 people? With d level of joblessness and d zeal to secure federal job, these applicants begin rush within all the centers all over the nation to write dis unplanned examination and screening exercise. As at the day of the examination dem compel our children to reach the venues atleast from 7a.m, and unu know say most people go need to travel a very long distants to reach the venue. After some of the applicants don struggle sleep Parks, Filling Stations, Brotels, and even School fields. Dem cum find am very difficult to bath the next day for d exam. Some of dem nor even eat just becos make dem for meet up wit the time for the exam wey unu put for 7a.m. After all dis numerous stress, unu finally start the excercise within 11a.m all over the federation. Before den na ordinary ground most of our graduates sidon put becos d environment nor dey conducive at all. Wit the joy of say exam wan start and without proper arrangement dis young ones begin step on eachother, not minding say females, pregnant and nursing mothers dey deir midst. Na so dem begin march d ones wey fall as dem dey run, in d process some dey break hand, some dey break legs. Some dey ground dey shout, yet no help. Soldiers dey flog pipo wey nor be animals for exam wey dem pay deir hard earned currency, time and other resources cum write. How long we go continue like dis for dis Nation? I Chief Okpubuluku declare d exam as anoda method of Bokoharamism. Wetin stop the examiners to conduct the exam within d federation, with dsame method of Waec and Jamb. Whereby applicants go sidon comfortable write deir exam with ease, then go House? Wetin stop dem to write the exam in three weeks, whereby separating the applicants as A for Ssce, B for Poly graduates and C for University graduates? Why must our Leaders conduct exam for thousands of applicants for one spot. How possible dem fit say dem go fit use take supervise the exam to select applicants by merit? After all set and done Nigeria Immigration Exam show for International media say Nigerians youth dey very jobless and within d process to get job for immigration more dan 20 people die during d process, so many people injured as some lost phones, bags, and credentials of original copies. We throway special greetings to our love ones wey die for dis battle, as we sympertise with our own Sapele pikin wey get fatal accident for Asaba rd wen dem dey come back the next day after d exam due to say dem nor get motor to come back on dat very day of d exam. Dis our pikin escort he wife go write d exam for Asaba. As a matter of fact the wife carry deir small child, for hand go and during the accident the Man break hand, the wife just recover from coma. Also one of the Osiohs also dey Sapele General Hospital.Sometin dey dis accident issue wey I nor fit talk becos e go bad if we lost two things once. After all dis pressure most of d pipo nor dey certain for job, but dem done already lost lives and valuables. Yesterday President Goodluck Jonathan dey officially dey throway authomatic employment for families wey lost deir person s. As 3 slots reach deir hands. Our question dis morning now be say so if person nor die from our families we nor fit get work as Nigerians? Also dis 3slots we fit compare am to the people wey we lost? I know the answers already. So make unu join us for Studio dis morning as we wish the souls of all wey die for dis deir immigration Exam wey Uncle Jona don cancel REST IN PEACE. I THE OTOTA1 OF SAPELE. THE URHUKPE1 OF OKPE KINGDOM. THE ASAMAIGOR1 OF ITSEKIRI KINGDOM. THE EAGLE EYES OF DELTA STATE. GOD BLESS SAPELE. ADIEU MY BRODAS N SISTERS. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Thu, 20 Mar 2014 05:59:45 +0000

Trending Topics




© 2015