SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. Hon. Godwin Atose! Hon. Godwin - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. Hon. Godwin Atose! Hon. Godwin Atose!! Hon. Godwin Atose!!! If to say u senior me,i for nor vex,reach d way i dey vex now for you. Just imagine the wahala wen u put for Sapele Local Govt now. You use ur Chairmanship Office take go Abuja go carry Miss Evelyn Isa come make am "Secretary To Local Education Board (Primary)" for where other qualified People dey for Sapele. I pity u,as u wan use ur selfish interest take rubbish Sapele growth,God pass you. I just dey look you with one eye,as u and Mrs Evelyn collect N200,000 to N300,000 from all the Head Teachers wey dey head all the Primary Schools now. Unu do am make e be say na only Okpe people nai unu put as Headmasters for all the Schools and we get qualified Teachers wen be "none" indigens but unu oppress dem. Make i tell unu,na we dey use our hand dey spoil our Govt Schools. D time wen we go Primary School,we nor dey hear Private School matter that time. Amany Private Schools Teachers get qualified Training wen Govt Teachers dem get? Pipo wen suppose Head our Schools so dat the future of our Children go bright as our own Bright. See some Primary Schools wen Govt renovate dem do am half,some dem just do the work like say na craze dey stay the Schools. Unu don give Private School Owners hand take dey exploit us anyhow like say we be fool. Money wen we nor fit pay for University School wen we go nai we dey pay now for our Pikin for K.G3. Wetin be unu problem self? Person wey due for promotion and we nor give am,den we cum go give who nor due for the position becos of Money,wetin we expect from dat kind person? So the money wen u commot from our Local Govt Treasury nor reach u take finish ur House wen dey Otite Rd,nai make unu dey collect more money from Headteachers to allocate School reach deir hands abi? I challenge all the Authorities wen dey above dis Mrs Evelyn Isa office to go probe wetin i dey talk about. We dey try to correct the problems wen Sapele and Delta State dey pass through,but unu tanda dey spoil Sapcity d more with unu Orukuruku method of leadership. Wetin be ur gain now as u don collect money from dem? Abi d money nor go finish again? You! Mrs Evelyn Isa as dem dash u office wen u nor worth,so u nor know say u go manage ur few Years for d office make u commot. I wonder the kind person unu be,as bad things nor dey hard unu to do. You Hon. Godwin Atose wey dem dey consider for PDP Chairmanship ticket,na dis kind attitude nai u wan use take occupy the seat? From my Studio wen dey Late Owin Family Room for deir Upstairs nai i use take dey warn unu say make unu withdraw the money wen dis pipo collect from Headteachers hand to put dem for different Primary School heads and also make unu re-shuffle the Heads of Schools and the none indigens wen don stay Sapele above 10yrs and done serve our Schools more dan the Okpe indigens and dem get above the qualifications of the Okpe Indigene. Since wey you Mrs Evelyn Isa enter dis office wetin be ur impact for the office wen u dey? Wetin be ur contribution to make our Primary Schools dey meaningful against Private Primary Schools. Well make i nor too talk too much becos i know say i go contact the Commissioner Of Education today to review all wetin i talk so and i bet unu wen wan spoil Sapele more say nor be our time and light must over shadow darkness for our era. NA THE OTOTA1 OF SAPELE NAI TALK. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Wed, 09 Oct 2013 05:09:26 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015