SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. I learn how to dey give - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. I learn how to dey give from the Rich to the poor,nor be becos say i hate the Rich,but na becos say,i know how e be to get NOTHING. I sidon dey take fresh air yesterday wen i receive WARNING CALL from my associate say some persons carry my matter go Sapele High Court go take permission to Track all my devices,say i dey bring unrest for Sapele and dem cum go MTN office,with d Affidavit to Track my calls. Wen i hear am,nai i open all my CCTV lines to detect who dey behind all dis yeye things. My pipo,clear conscience fears No accusation,as i dey here so,to remain Ghost Mode na my Trade Mark,but i nor fear shit fear aboki. If at all say dem mistake unveil me,nai be say na War for Court,becos i believe say God nor dey sleep and na d level wen some small Lawyers wan take blow nai just be dis for Sapele. Immediately i hear dis Red Alert nai i call Studio to verify d report via Ghost eyes. Wen we map out our calls and search we cum find out say Sapele Okpe Community hand dey inside,and if nor be d entire Excos,nai be say the Chairman Moses Ogodo hand dey inside and other persons. Now make i ask Moses Ogodo wen be Esan Man wen dey head Sapele Okpe Community as land owners say,wetin be d meaning of Unrest and make e refer to us for dis forum the kasala wen dis page don bring out for Sapele. Well wen i call my Lawyer and tender the complain wen i hear about the Tracking issue,we cum discuss extensively and i cum find out say na when i dey use my phone number for Crime nai d network get right to Track and release my info to 3rd party. So i mark today down,as MTN Sapele Chapter and all network authorities wen go conspire wit Moses Ogodo to track any of my line,say dem go tell Court which Crime i don commit wit my lines? I also know say,the Court wen give and grant dis move don sign wahala wit Supreme Court becos dis na Incompetent Judicial practice nai dey go on so and we go fight am to d end wit anybody or group of persons wen wan stop dis forum from achieving its desire goals,to sanitize and enhance Development and Growth for Sapele and Delta State. I remember say na Seplat issue nai be d last bet wen relate me and d Community on Articles,but since the Community nor wan change from deir evil practice to dey oppress deir pipo and dey slash deir Salaries and dem nor want make anybody dey oppose dem,nai make dem wan fall deir hand for our body,i go tell dem say na sand sand play be that,as i don pass dis level. As i sidon for Olympia dey cry all thru d Night wen make God use dat Heavy rain take wash Sapele over d night na sign of defeat to all our enemies already for Sapele and Delta State. We from dis Platform don discuss issues wen affect Sapele and Delta State,and by the grace of God,we don achieve so many things,we don print SAPELE TAFIA for the sand of Sapele and Delta State,including the Nigeria and Abroad. Today i carry the Holy Ghost pot of life and death and i pour am for Amukpe Roundabout,say anybody wen nor want Sapele and Delta State to better nor go pass June dis year and i oppose anybody wen feel say e go stand against dis Prayers becos gone are those days wen Man go dey fear to talk d truth. I rather Die for truth than to die without meaning. I frown to announce to all unu say soonest i go shut down all my CCTV Cameras and i go Travel leave Sapele for Moses Ogodo and i promise Moses Ogodo and anybody wen dey behind dsi evil Tracking issue say,i dey go and i dey cum back wit full force and i promise all unu say,my coming back na with golden sword,to cut any soul of Hatred against dis platform. At a time wen NO one fit stand oppose LIES from our Government,we from dis Platform do am. At a Time wen Community Leaders dey sell our Industrial Lands to individual for personal gain. We from dis Forum stand gidigba correct dem. At a time wen the less privilege nor fit Boost of One Basket of Rice for Xmas Celebration,we from dis forum,wit d help of God,distribute Rice to more dan 92 Families from our Society. At a Time wen a particular Widow almost park commot from Houx,due to lack of House Rentage,we from dis forum,restore joy to the Widow and her family life. At a time wen Widows nor fit kill Fowl,we distribute N5K to more dan 23people. At a time wen our Youths dey die for Army hands,we initiate HSE Training and we engage d few to know the value of Life and today,NO more Army beating indiscriminately. At a Time wen Projects dey de abadone we stand to oppose the Contractors and we from dis forum dey witness the changes. Yes Yes Yes Yes. We know say Truth dey bitter and nor be everybody go gree accept am,but if Politicians and Community Leaders think say we dey bridge Peace for Sapele,make dem begin do the nornal things for Sapele and Delta State to restore the lost glory of Sapele and Delta State. Things wen dis Platform don achieve,my fingers nor fit talk am finish and i rest my struggle. I stand for Olympia front and i pull my shirt challenge Moses Ogodo and all d pipo behind dis struggle to come out and increase deir pursue,Technologies and all factors to catch d Man or Woman behind d Mask,as i don ready to split my blood to make sure say atleast somebody sacrifice e Life to make sure say Sapele lost Glory dey restore. I still dey investigate the full names behind dis act,and i promise to publish all the names within 24Hrs to expose all unu Evil acts and d end shall tell. I Remain The Otota1 of Sapele. The Urhukpe1 of Okpe Kingdom. The Eagle Eyes Of Delta State. GOD BLESS SAPELE. GOD BLESS OKPE. GOD BLESS ITSEKIRIS. GOD BLESS DELTA STATE. GOD BLESS NIGERIA. GOD BLESS SAPELE TAFIA. GOD BLESS YOU ALL. The struggle continue and Winners never Quit,so this fight must continue,becos we nor dey fight Physical combat,but against Spirituality and Powers from d Evil world and as long as God reigns we dey above all our worries. I call on all our Lawyers Home and Abroad to commence Case against Moses Ogodo against Human Right Violations. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Fri, 17 Jan 2014 06:19:16 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015