SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. My Dear Safarians - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. My Dear Safarians Worldwide. Unu good Morning,na me the C.E.O of Sapele Tafia Chief Tafia Okpubuluku. I don see say,we fit use dis Forum take do the small thing wey our power reach,wit d grace of God to uplift and to affect the Town positively. Nor be to sit down everyday dey complain about Government or dey castigate people evil side to change nai be our contribution to Sapele and Delta State. We fit just show somebody care,and dat care of financial assistance fit commot dat person from the Street and dat person fit remove e brodas and friends, and before we know it,we don dey sanitize d youths for Sapele morally and all dis crime wen we dey complain about,go come reduce. Just becos we affect d Youths life positively. We get better Leaders for Sapele wen sabi give our Youths money and the Youths nor dey think anytin pass Drinking, Flirting Smoking and Eating. We nor say na bad tin,but wen dat money finish,the Youth go cum dey stranded again and e go cum dey find dat person to dash am money again. I throway myself for ground take beg unu say make we join hand assist our Sapele Boys and Girls wen get interest for Oil Work,either now or in future. As Free H.S.E Training ( Level 1 & 2 ) onshore/ offshore Courses dey go on now for their site Mission Rd by Water board Interested person suppose come with N10,000 for their text book only and na 2 weeeks programme. We dey solicit for unu support, for any amount of persons wen you go fit sponsor from our page wen dey jobless? Na beg we dey. We don alert many persons before today and some don respond positively as one Uncle; *Tony. *Simeon. *James. *Edward. All dis people together don assign to pay for Seven persons wey fit come out say dem wan go Learn dis work,to acquire skill training certificate to boost and upgrade deir standard of living,so dat dem fit also get work and dem go come be Train Skilled Men and Women wen Oil Work go come dey find IJN. Amen. We from our Studio dey call on meaningful Safarians wen dey Home and Abroad to assist our people wen dey Home here,with anything. We fit choose to sponsor 1 person,wey be N10,000 and also if God don bless you and you feel say you go fit assist more than One (1) person from dis our forum then please help. Our Sapele Boys nor like fight and Cultism. Na d stupid negative influence wen some learn from dem senior nai affect deir Life. So we need to apply caution,hence some of dem go pass dat same knowledge give deir surrounding and if we nor take care crime go dey pass from one generation to d other. From our Studio we don see say we fit bring dis our Children out from bondage and change deir life. Now some people dey feel say na we dem wan pay the money give. No. We nor want anybody money but we go accept anybody wen agree to support anybody via Comments Here or Via Inbox. Then we go cum also accept and screen anybody wen indicate interest to go learn. We go use dis method. Who wan help cum Inbox. Who wan go for d Training wen nor get money,cum Inbox also. Then we go Direct the Sponsorers to pay to the Company directly and we go send the names of the person wen dat person dey sponsor,so dat money nor go pass our Hand,as we nor need am. Also if we see say you nor fit pay directly to the Company,we go advice you to pay to some important persons for dis Forum wen nor fit chop our money,so dat na d person,go personally go pay for d indicated person and na him go also drop d name(s) of d person(s) wen be next from our Studio. *I assure unu say Money nor go pass through our Studio. *Money nor go pass the Apprentice dem hands also. With dis we go help to affect ourselve positively and by dat we dey create job for our youths and also we dey reduce crimes from our Town. All unu wen dey dis forum wen think say e need dis Certificate and e nor get money join the four people wen we don already get now,either for here or for Inbox. From Olympia Roundabout wen i stand put dis morning,nai i use take dey nack Bell dey shout go Heaven,say touch our Leaders,and all those wen done ready to assist us via dis Training financially. We say God Bless deir families and their Children. Also we dey shout to touch more people hearts from dis Forum to help all those wen don dey cum inbox for dis work IJN. We cover all d Applicants wit Blood of Jesus,so dat dem go fit go learn and complete deir training successfully. Baba for people wen nor fit help today and dem get interest to help,we say Baba God provide for dem also In Jesus Name. Amen. Oya make i go sidon for Inbox to mark d names of those wen wan pass dere do deir contribution and also indicate deir interest to go learn d work. Unu fit indicate for Timeline and also for Comment Box. Lets Go. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Sat, 02 Nov 2013 05:36:05 +0000

Trending Topics



TV anuncia : Cantora Taylor Swift está no Brasil ! EU : O-O O-O
MAJOR FIRE UPDATES AS @ 6:45 am on the 19/10/13. Watch and Act
Fooooooooood!! I have learned so much about food over the last

Recently Viewed Topics




© 2015