SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. SAPELE TAFIA STUDIO. Via. - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. SAPELE TAFIA STUDIO. Via. Delta Rainbow Television Warri Dear Hon. Henry Ofa. I dey very happy to write you dis letter,and i hope everytin dey well with u and ur family. If so doxology. Hahahahahaha. The very purpose wey make me,the Otota1 of Sapele dey write u dis letter na to remind you the Oath wen you take d day wen dem swear you enter your office as Commissioner of Desopadec wen dey represent the Urhobo Ethnic Nationality. I like make u know say,na becos of ur contineous loyalty wen u play during Ibori tenure and d role wen u play during 2011 Gubernatorial Election nai make dem give u dis office wen u tanda put. When Rt. Hon. Victor Ochei led Delta State House of Assembly on August 11,2011 swear unu in after Oga Governor nominate unu give the House,nai dem instal Oritsua Kpogho as unu Chairman alongside u; Hon. Henry Offa. Hon. Joseph Ogeh. Hon. Micheal Diden. Hon. Johnson Boro. Hon. Rev. Chukwudi Eke. Hon. Barr. Benedicta Osakunih. Kingsley Otuaro. Dr. Peter Egedegbe. Wen constitute the new Board. Unu pledge unu support to bring change to d system,due to the fraud wen d previous Board commit wen Chief Wellington Okirika dey incharge. Na since na we dey pray make dem approve our dis year budget for our Delta State Oil Producing Areas Development Commission. Now as dem don approve your portion give you to develop our side,wen u dey head,nai make i say,make i remind you of all wetin we don talk before about wetin you go use the money take do. I know say before d money cum,dem first screen your proposal,so u nor suppose go outside your proposal. I believe say the Street Light for Market Road,starting to the end of d Road,dey among ur budget and u go agree with me say Sapele Main Market Road lack light to helep the Traders dey see when Night fall,and even we d buyers wen dey close for work for night,dey find am uncomfortable to buy things wen light nor dey the Market Road. Also pocket pickers nor go dey see where dey run pass,if light dey the Road. I understand say na Ethiope East,Okpe and Sapele nai u dey represent. But na Sapele own nai i dey talk about first,den e go good make u touch those oda Localities also,so dat dem go feel ur impact as the better person wen you really be. Becos wen i check ur profile,i see say u go inspect; *Six Class Room blocks for Oreki Primary School Oghara. *Science Equipment for Oreki Secondary School Oghara. *Hospital Road Oghara. *Solar Water project for Oghara junction. *Administrative Building for Mosogar Palm Wine joint. *Solar Water Project for Jesse Roundabout Atiwor rd Jesse. *Okunigho School, Jesse. *Six Unit Toilet for Eziafa Grammar School. *Health Centre for Mission Rd Sapele. *Okoloko Gamon Bridge rehabilitation. *Lawrence Rd Repair. Etc. U don try and i join u fault Community leaders wen dey allow youths dey harass contractors wen unu give work to develop our communities. You know say the Rural leaders for Oghara call u square peg in a square hole,as u dey work well to develop d society wen u belong to. I norva give u my own Title,becos i nor dey carry dey give Politician respect. Now make i nor too talk becos i know say God go use u well and u go stand by the Oath wen u swear before u take dis ur office. According to wetin we talk before i tell u to buy and donate Transformers to Sapele community to boost our light,but as e be now,we nor need Transformers again,as the new company wen go take over Light by January go handle dat for us by then. So make u do dis as my special request for the people wen dey Sapele to also benefit from ur good work. 1. Street Light for Market Road and Hausa Rd. 2. Three Coaster Bus wey go dey helep our Market sellers dey go House from Market or to Market,wit less charges and the Drivers go dey on constant salary. 3. I want make you helep us do Adeniyi Road and Ireto Road fron the starting to the ending,so that people wen dey stay dere go happy pray for ur unborn generation. Now dis na wetin u go do. Share the budget wen cum our side (Ethiope East,Okpe and Sapele Local Govt) into 3 and make u use Sapele own for this first 3 things wen i outline for you. I know say change go remain,but make u do our mind first,so dat we go know say na wetin affect the general masses nai u do for us,say nor be ur own selfish purpose nai u dey fight for. Also my advice for u be say,nor give ur friends the contracts,so dat dem go hammer. Give the contract direct to the Companies wen know how to do the work well. I nor suppose tell u say na Oghara wen u from come nai u don use ur Office assist pass. So make u try do wetin we ask for now,make we know say yes u be correct man wen e second name na Development. Make i go sidon with Desopadec Secretary Sir Austine Ogoro and House Committee Head on Desopadec Daniel Mayuku,make we discuss amuch dem allocate cum our side,so dat we go know weda u really try at the end or na lie. I hope say my letter go get better consideration. Extend my regards to ur family. Yours Faithfully. SAPELE TAFIA THE OTOTA1 OF SAPELE. THE URHUKPE1 OF OKPE KINGDOM. THE EAGLE EYES OF DELTA STATE. Hope say na wetin unu want nai i talk? Or if you wan add join,oya add make i see weda na wetin Desopadec go fit do for our genetal benefit. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Fri, 25 Oct 2013 05:15:30 +0000

Trending Topics



Sugarcane (El Canaveral) - Samuel Lopez A short documentary

Recently Viewed Topics




© 2015