SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. SAPELE TAFIA WELCOME GOVERNOR - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. SAPELE TAFIA WELCOME GOVERNOR UDUAGHAN FROM IRELAND. Delta State Governor Emmanuel Uduaghan dem say u Win International Outstanding Leadership Award By Metro Éireann Newspaper Ireland! The governor of Delta State, Dr. Emmanuel Eweta Uduaghan, on Friday of January 17, 2014 participate for one Mini Investment Summit for Delta State during where he go for meet with Irish investors as our Governor claim say e go helep us seek to take advantage of the investment potentials for the oil and gas rich state. Uduaghan lead e team of managers of the state’s economy go Ireland during d visit, e receive International Outstanding Leadership Award by Metro Éireann, Ireland’s leading and only multi-cultural newspaper wen dey Ireland. For dis summit,the programme focus on how to attract Investments to the non-oil sector under our Governor Delta Beyond Oil initiative with emphasis on Agriculture and aqua-culture, exploitation of mineral and natural deposits as well as power and energy. Deltans worldwide how long we go continue like this for Delta State? Na so our first Oga wen cum from Oghara wen dey Boarding House for U.K carry our Money go U.K go negotiate for Mechanize Agricultural Farming,yet na 45Percent of Songhaii nai dem fit erect and built,as na the Total 100% nai our then Government withdraw from our State Treasury. Yet the essence of Songhaii wen d Govt declare say go helep us reduce; *Youth Restiveness. *Fight Unemployment. *Increase Food Production. *Create Job off Oil Needs. Etc. All dis idea die and fade away even before d end of Chief James Onanefe Ibori regime. Now if our incumbent Governor really get Delta State for mind,atleast instead of to waste more money for Foreign Investors to cum develop our State on Agriculture,e suppose think of how to rehabilitate SONGHAII to current standard wen go make all those dreams cum to stay for Delta State benefit. Wen i look the issue with microscopic view,i cum see say our Delta State University Students wen dey Faculty Of Agriculture fit even dey use the developed Songhaii for Practicals. Also if we enhance d place,we fit make am Tourist Centre wen go dey bring foreigners to Sapele and Delta State for relaxation and excursions on students to see life and wide animals,wen fit grow annex to become zoo,with Delta State five Star Hotel close to am. We norva fit maintain d Investments wen dey ground,we dey go abroad dey go lavish money to the benefit of other pipo economy wen don already better and we dey boost deir Gross Domestic Product index and GNP. The other day we hear from News say dis same Government don buy new set of Buses wen go assist on Transportations,where as we get other Buses and Corollas wen we don buy before and dem norva spend up to 2Years,yet unu auction dem to unu selves and wen i complain from Studio here,unu say na d duration of time wen d Cars don spend nai make unu auction dem. Na so unu dey auction unu personer cars every 2 to 3 yrs? If we dey talk about Agriculture,make we forget about new Investors from Abroad and make we focus on wetin we get for ground here. Just as our Governor join other Medical Doctors for the Transplant wen dem do for Oghara Teaching Hospital,wen make big name Oba of Benin commend am put,wen our Governor go pay condolence vist give the Oba,wen lost he first wife,na so other Professors go join hands to lift Delta State beyond OIL and dem go also commend dem one day,so dat our Youths go begin do mechanize farming,within all d Local Govts so dat improvement for Food Production go dey,Unemployment go dey eradicated and Crime,like dis issue of Kidnapping wen just happen so, go reduce well well within our State,becos by den,we don engage the youths for better life. Today i challenge the State Govt to stop magomago Capital Expenditure on irrelevant Agricultural dialogue to fool us wen be d citizens of Delta State,becos. D money wen all unu take pay for tickets dey go receive one plague of white stone and aluminium pole come Delta state say na Award? Make we big up for that Govt House becos na we get the money,only say we choose unu to represent d State,on developmental issues,but unu don turn d tin to unu own benefit and unu feel say nobody go ask unu question? I dey wait for unu to come Sapele again cum campaign for any public office. Na where dey pain person nai e take dey near fire. Oga Governor show me one sector wen u don try upgrade and over try,wen nor need intervention again for dis State? Wen u dey duplicate expenditures dey follow Capital Expenditure. God Bless Sapele. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Fri, 31 Jan 2014 05:26:46 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015