SAPELE/DELTA STATE MUST - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. 16/06/2014. ANNOUNCEMENT!!! From The Government to the people. Our studio carry mouth call Government representatives wey dey demolish illegal structures for Sapele and dem come talk say dem nor go demolish today due to say dem wan try evacuate the remains of the things wey dem don demolish out from the once wey dem don already demolish and dem start work from Amukpe yesterday only say one of deir caterpillar cum go spoil. So dem dey work on am why d oda one still dey work now. So dem go evacuate today and dem also go commence demolition tomorrow. As a result of d demolition. Dem dey likely to enter Awolowo,Akintola,Cementry and Adeola Roads as from tomorrow. So if u know say ur illegal structures still dey road and dey kankpe try remove am before dem go come helep you remove wrongly and maybe destroy other valuables wey dem nor suppose remove. Report and rumours don dey fly for the town say Governor nor instruct dem to destroy market road,as e give dem two (2) months to finish the market,but yet Hon. Ben Igbakpa and Omare Frank demolishing team still embark on market road demolition. When our studio hear dis talk,we cum throway calls give the Honourables wey dey incharge of d demolition,but dem cum explain to us say Governor nor talk anytin like dat and dem cum talk say, Governor frown say the work dey slow sef. My people make we try dey carry rumour wey legit make we nor go dey talk wetin go insight communal dispute. Dis pipo don already start d work so make we allow dem complete am. Man nor dey know finish,maybe na here nai God wan use answer Sapele prayers we norva know. Yesterday nai we from studio take time take waka round Sapele to cover all the areas wey dem don demolish so dat unu wey nor dey Sapele fit dey see wetin we dey talk about becos e nor go good make we just dey talk without proof. When we see that Sagay pikin upstairs wey dey Cementry Rd by Market Rd we nor like d half work becos d tin fit go collapse wen cars dey pass or park for dere and e fit cause major problem. So we cum call Hon. Ben wey short like e Oga,e cum explain to me say dem call am say GOODS dey d inner store nai make dem leave am half demolish so dat d pipo go fit go remove deir things later. So i don tell am before and i go talk am again say make dem go fall the building after dem don pack deir things commot finish to avoid casualties later on. We all know say Sapele dey dirty before now and the caravans too much but with dis demolition we sure say things go better or e go worst becos dis people wit illegal stores get families and na some of dem be d breadwinners for d Home. So without alternative means for deir businesses,how dem go fit use survive with d current hardship for Sapele? Also i dey beg unu wey dey along the major roads wey dem don demolish pass,say make we nor use our hands take bring more problem for ourselves as Army don begin dey flog pipo wey go dey shade for those places. Make we excercise patient make dem do all wetin dem wan do make dem commot in peace becos even me dey vex sef,but wetin i fit do pass to write? This na d pictures of most of d demolition around Sapele. Na Me The Otota1 of Sapele. The Urhukpe1 Of Okpe Kingdom. The Asamaigor1 Of Itsekiri Kingdom. The Eagle Eyes Of Delta State. WETIN BE SAPELE FAITH AFTER THE DEMOLITION? God Bless Sapele. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Mon, 16 Jun 2014 06:44:04 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015