*SPORTS TREK -PROUDLY SPONSORED BY MILKY PEARLS BEAUTY CONCEPT - TopicsExpress



          

*SPORTS TREK -PROUDLY SPONSORED BY MILKY PEARLS BEAUTY CONCEPT (MPBC) IGHO Fc Sapele and LILY Fc Sapele nai open Emete Gold Cup competition wey start yestaday for Sapele Stadium. Naso Igho Fc use Lili Fc take do suya as Bright Pan with he fry pan head and Ifeanyin Gboge score the 2 goals wey Tekeri boys take win Suru boys. D match end 2-0 but Lili Fc try their best to bounce back wit Ufuoma Ajamikoko and Jemine Tatie, Ibori Grikpa, Ifeanyin dey husstle for Lili Fc but Igho Fc stand gidigba like rock with Captain Orukpe, Nonso, Aigbe Aghahowa, Ifeayin Gbobe, Chinedu Awunor, Bassey and Bright pan dey control d play. Godwin Atose, Tunde Okiki, Elvis Erudje, Dr Adu, Dr Ofuofo, Coach Oviz, Endurance Ojokolo e.t.c dey among dignitaries wey con watch d game yestaday. Na Sundorf Academy go jam Sapele Academy for Remand HOME today by 4pm. Na me go ref d match. Igho Fc say dem dedicate d victory to their Oga, Mr Igho Otekeri and Mrs Blessing Okagbare Otekeri. Chelsea don pour sand for Liverpool garri for inside dia house afta dem bulala dem 2-1 for d game wey happen on Saturday for Anfield. Na Liverpool fess score for d match, and naso all Liverpool fans kon dey jolly as dem wan make dia boys spoil d unbeaten run wey Chelsea dey play. Liverpool take beta nakin start d game, and bifor Chelsea sabi wetin dey happen, Emre Can don tear net for d club wey no dey waka alone. Na wen Liverpool kon score, nai Chelsea kon open dia eyes kon begin dey tap beta ball wey sweet all man wey watch d match. Defenda Gary Cahill and Diego Costa be d two playas wey score d two goals wey Chelsea take win dem match for Anfield. Liverpool fans vex well well wen d match enta mortuary time as dem bin dey shout say d referee suppose give dem penarity afta d wicked shot wey Liverpool skippo, Steven Gerrard play touch d hand of Chelsea defenda, Cahill, but d referee kommot eye. Chelsea agbero fans juss dey dance shoki afta dem bulala Liverpool for Anfield sake of say dia unbeaten run dis season dey kamkpe. Southampton futbal na die now sha, as dem waya Leicester City 2- kondo for house, plus Manchester United manage waya Crystal Palace 1-kondo, as dia area pipo, Manchester City play 2-2 draw wit bottom club, QPR, Sweasea use Arsenal take swim like tilapia fish as dem do Arsenal to vormit by 2-1 Barcelona don win dia fes match inside two matches for La Liga as dem come from back take beat Almeria 2-1. D Catalans bin lose 3-1 to Real Madrid for Bernabeu, come drop anoda three points for house wen Celta Vigo beat dem 1-0 las week. But dem don dey win now as dem beat Ajax 2-kondo bifor dem win Almeria wey bin wan do dem ogbori style. Almeria no siddon wait for Barca to settle bifor dem begin attack dem upon say Barca coachi Luis Enrique bin drop Neymar, Xavi and Luis Suarez for bench. Congo striker Thievy Bifouma come chuk hand for Barcelona eye as hin score d fes gol of d match as Barca bin nor fit put dia shoe well for d match. Luis Enrique come start d secon haf with e sabi playas as Suarez and Neymar enta and na d two of dem come combine ekwalise for Barca. As match dey enta mortuari time naso Luis Suarez again come locate Jordi Alba wey run enta Almeria defence and d defenda sef come nak ball enta net for d 82 minute to make am 2-1 and naso d match finish. Real Madrid tanda for Bernabeu as dem take one hand take dash bakhand slap to Rayo Vallecano 5-2. Cristiano Ronaldo sef score for d match as Gareth Bale wey just show from injuri add e name for d parade. Toni Kroos, Karim Benzema and Sergio Ramos na d oda playas wey score for Real Madrid as Alberto Bueno be d playa wey score for Rayo Vallecano. * NA MILKY PEARLS BEAUTY CONCEPT (MPBC) THE OGBONGE MAKE UP PIPO NAI SPONSOR TODAY SPORTS TREK. Na their message be dis- Are you a Nigerian? Get a classic Make-Over for your weddings,event and fashion show by Milky Pearls Beauty Concept this Christmas holiday at affordable prices.. Thinking of Make-Over...Think..M­PBC and experience an Exquisite touch. Soon ..Have you booked? For bridal Make-Over? Hurry and start booking to avoid disappointment this holiday!!! MPBC na where beauty be our concern..Contact us today via- 08067106174 08111615491 BB pin 2B1C64F5. Like our Page @ Milky Pearls Beauty Concept to view more on your favourite look. MPBC...Beauty like youve never seen!
Posted on: Mon, 10 Nov 2014 10:32:42 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015