*SPORTS TREK WORLD CUP UGBENÉ Money palava don dey shelle - TopicsExpress



          

*SPORTS TREK WORLD CUP UGBENÉ Money palava don dey shelle again for d camp of d Supa Eagus wey dey tap ball for dis year World Cup for Brazil, as d playas nor gree train yestaday evening. Supa Eagus playas suppose train last evening for Campinas, and even d bus wey go carry dem enta stadium don pack for dia hotel, but d playas no gree come out. Supa Eagus playas talk say na must make d Naija Football Federation (NFF) pipo pay dem all dia bonus bifor dem go gree train. Dis na d secon time wey d Supa Eagus playas go enta d same trouser with d NFF pipo ontop money matta, as unu remember wetin hapin last year bifor dem enta Brazil for d FIFA Confederation Cup. Meanwhile, our studio con hear say NFF secretary, Musa Ahmadu don rush enta Naija as d man dey find kudi wey dem go take pay Supa Eagus playas. “As I dey follow you talk now, our secretary suppose don enta Naija as e go find money wey we go take tap ball for d next round,” naso one Oga for NFF yarn. Naija go jam France on Monday for dia last 16 katakata match, and nor be dis kain time nai d playas suppose dey do dis kain yeye thing. “I don tap ball for Naija for 2 World Cup, and e reach 3-4 months bifor d NFF con pay us our bonus, and I nor even understand why dis playas nor wan cool temper,” naso foma Supa Eagus strika, Victor Ikpeba yarn plenty our tafia wey dey for Brazil. Beta don shelle for Algeria as dem kuma-kuma don join Naija as d only two African teams wey go tap ball for d last 16 for dis year World Cup wey dey carry on for Brazil. Na d goal wey Islam Slimani score for d secon half nai helep Algeria enta d next round as dem follow Russia play 1-1 for dia lass Group game. Make unu nor forget say Oga coachi for Russia, Fabio Capello been don talk am bifor he boys even jam Algeria say fear dey catch am for d match. Plenty Algeria fans now don enta street dey jollificate, becos dis na d first time wey dia country go enta d next round for d World Cup. Na Belgium carry fess for Group H, as dem win all dia 3 games for d Group stage. Oga coachi for Algeria, Vahid Halihodzic con dey dance skelewu and sekem dance afta he boys don kwalify enta d next round. Algeria must now shine dia eyes well well becos na Germany nai dem go jam for dia next match wey be win or waka (na knock out oyinbo dey call am). Naija, Cameroon, Ivory Coast, Algeria and Ghana be d 5 African teams wey enta Brazil for dis year World Cup, but na only Naija and Algeria fit make am enta d ness round. Oya make unu look d significant Nige(RIA) and Alge(RIA) Abeg RIA too much. Make unu clap for RIA. Real Madrid winga, Cristiano Ronaldo nai score d goal wey Portugal take bulala Ghana for dia last Group game, but d kasala wey con shelle be say d two of dem don crash kommot for dis year world Cup. Portugal and Ghana don know bifor dem jam diasef for dis match say na 50-50 be dia chance to enta d next round, and nai con make d two of dem waya diasef plenty shot for dis match. Na wen d match enta 31st minute nai yawa kon happen for Ghana as dia defenda, John Boye score for he own net. Asamoah Gyan kon ekwalise for Ghana for d 57th minute and naso all African fans kon dey halla say make Ghana score d secon goal. Ronaldo nai con wound Ghana kpatakpata wen d match enta 80th minute as he score d goal wey dem take win d match. D goal wey Ronaldo score nai be he fess goal for d 2014 World Cup, but d goal nor fit helep Portugal enta d next round. Na Germany carry first for Group H, and na USA carry secon position for dat Group. Vincent Enyeama don put impressive display for goal post for Naija since wey d 2014 Fifa World Cup start for Brazil. He last minute save wey take deny Edin Dzeko goal as Nigeria beat Bosnia-Herzegovina 1-0 nai be Enyeama finest moment so far for Brazil. Oya make unu read dis oyibo That moment of sheer genius is however just one of many so far provided by the goalkeeper who is currently ranked as the best of all shot-stoppers currently in Brazil by FiFA Vincent Enyeama nai be d current Africa’s best player for the 2014 World Cup for Brazil with 9.59 points for the latest Castrol Index Top 10 rankings wey FIFA release. Na Only Karim Benzema (9.77), Robin Van Persie (9.72), Arjen Robben (9.67) and David Luiz (9.63) nai pass Vintoto Enyeama for d ranking. Oya make unu clap for Enyeama. No match today but 2mrw wey be Jun 28 by 9:00 PM, Colombia go play against Uruguay, while by 5:00 PM, Brazil go jam Chile. All na d knock out stage. Na First Bank NIG. PLC Nai sponsor today Sports Trek.
Posted on: Fri, 27 Jun 2014 09:36:24 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015