SWEET MOTHER Sweet mother I no go forget you For dey suffer we - TopicsExpress



          

SWEET MOTHER Sweet mother I no go forget you For dey suffer we you suffer for me yeah When i dey crry my mother go carry me She go say my pikin wetin you dey cry yeah yeah Stop stop! stop stop!! stop stop!!! Make you no cry again oo When i wan sleep my mother go pet me She go lie me well-well for bed She go cover me cloth say make you sleep Sleep sleep my pikin oooo When i dey hungry my mom go run up and down She dey find me somthing we i go chop When i dey sick my mother go cry cry cry She go say instead wey i go die make she die She go beg God, God help me, God help me, my pikin oo If i no sleep, my mother no go sleep If i no chop, my mother no go chop She no dey tire ooo Sweet mother i no go forget dey suffer wey you suffer for me yeah yeah You fit get another wife you fit get another husband but you fit get another mother? No!
Posted on: Sun, 02 Nov 2014 19:32:28 +0000

Trending Topics



tyle="min-height:30px;">
CAVE FRENZY! Run through the caverns and pick up as much gold as
Most people have a favorite hot, caffeine-boosting drink that they

Recently Viewed Topics




© 2015