Short Note to Aso Villa Oga Joe, how level? I hear say u don vex - TopicsExpress



          

Short Note to Aso Villa Oga Joe, how level? I hear say u don vex sack army thief abi nah chiefs, God bless u. nah now u dey du like water side pikin, I hear say u reach Tupkur side self? No lele. I beg make u nor forget look Stella side as u don provoke so, kuku provoke finish sack stella, use Ogboju pursue dat woman, she dey fall ur hand. I know say all dis people wey dem dey call stella dem too strong, nah so we see Stella Obasanjo now we come see Stella Jonathan , sorry Stella Oduah, all join sha,. Nor forget oo, OnlyYar Adua nor get Stella but the good man nor last, If u dey fear, take dat brukutu b4 u giv am letter. Se u dey hear wetin i dey yan so? Ok nah e go be , we dey wait u 4 b side 4 2015. Nah me ur guy Akpors.
Posted on: Thu, 16 Jan 2014 16:54:24 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015