Son: Mama, this president no dey do anything o! Mother: Shut up no - TopicsExpress



          

Son: Mama, this president no dey do anything o! Mother: Shut up no dey talk that kind shit, you no know say na from our village e come? Na hin dey represent our tribe now o! Son: say wetin mama, e dey represent us and na wetin e don do for us here? Mama: I say shut up! Other tribes no wan make we rule, but now god don put this man there for us people con dey vex. Son: Mama, e no change anything. Our situation never change, no road, no light and na for river we still dey fetch water. Na him family e dey settle jare, me I no dey that kind solidarity o! Make I dey suffer and be smiling? Mama: Na like that for Nigeria o! You must support una own person, whether e do am well or not I no care; as far say him be my tribe man nothing do me. Son: Yeeee! I don suffer o! Shey na like this we go dey? #NigeriaIsJustAnEntity. #SNC or we sink.
Posted on: Sat, 27 Jul 2013 05:24:51 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015