THURSDAY 28TH AUCHIPOLY NEWS LIVE: UNA GOOD MORNING - TopicsExpress



          

THURSDAY 28TH AUCHIPOLY NEWS LIVE: UNA GOOD MORNING OOOO......... MUCHI CARNIVAL MUCHI CARNIVAL !!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!!! Today na muchi carnival and na Dada milla nai dey organise am today from 8pm till dawn so make una show there live............... HND form don dey on sale @ eco bank for 10,500 make una rush go buy now oooo........... Them no go sell change of course form oooooo so make una take note........ Dis na waiting on boy send enter our inbox! I greet una 4 d hux ooooh. Abeg makeuna help me my name na Godwin mirabel odion I graduate lastyear frm OTM(OFFICE TECHNOLOGY AND MANAGEMENT) na CS I follow enter as I dey b4 I graduate na so I begin get problem 4 result I go write exam I nor go see result nor be say I pay skul fees late oooh, nor be even only me we many well well.as I dey talk na I never see my CS year 2 first and second semester result and becos of dat one na I never fit do online 4 ND final not to talk of to get d result. Till we graduate na so so dem dey work on am na we dey hear and HND form don come out na how I wan take buy am to top d matter now we dey hear say dem say we go pay dis year skul fees again abeg make una help me cos I don taya 2 dey cry in silence abeg na beg I dey make I nor go carry heart attack... Tank u Dis na waiting somebody send for our inbox!!!!! I beg make una help talk to all doze lecturers way D̶̲̥̅̊ε̲̣̣̣̥γ̲̣̣̥ changepple result Bcoz i get friend way suppose buy HND form nw e no fit buy bcos dem change e result Hw U̶̲̥̅̊ go expect person way D̶̲̥̅̊ε̲̣̣̣̥γ̲̣̣̥ get upper fron ND1 cumreach ND2 ist semesta den second semesta reach na pass econ D̶̲̥̅̊ε̲̣̣̣̥γ̲̣̣̥ c himselfNo b say dem tell M̶̲̅ε̲̣̣̣̥,,,i c Am for myselfAbeg try put am 4 ya news so dat e no go happen to anoda person!!! Hmmmm auchipoly lecturers make una change ooooo........ Spat exam na september 29th so make una take note oooo......... On lecturer wen dem dey call. Mr igbadume report don full our inbox say he dey too dey pack carry over give students join blocking wen dem do, hmmmmm e b like say u don tire 4 the lecturer work ooooo........... Report reach us say some cult boys wan go kill one mike ekweku wen be business admin students ND2 and na dis night dem wan roll go he house, if anything do that boy I swear una go know who I really b bcos I go publish una names give state security agency benin city, so make una try am........... Another report enter our table say dem go soon paste the balance spat result wen dem never paste today and tomorrow so make una take note oooo........... Report reach us say fire almost burn down castle villa for power line as one girl on her electric heater down go sleep her boyfriend place, na her neighbours nai come break her door to off the huge flame of fire,hmmm ashawo no good ooo.......... Make una wen wan runz una ND admission small small oooo cos fake people full everywhere ooooo hmmmm who get ear make he hear oooo........... School fees go expire tomorrow for those wen never pay and we also hear say dem do add 5k join since on the 31st of july............ Make una no vex for the long awaited MC Mr Lecturer and beta pikin wahala wen shelle wen we never give una, na bcos say we still dey gather detail regarding waiting sup dat day of the election so make una still hold patience small.......... Abeg I wan take God beg dis cult people wen dey wear Yellow and Black say no be una nai start that cult ooooo and the way una dey cast una self and they take am dey oppress students no good and make I wan una say if una no stop all those nonsense I go begin publish all una names here 1 by 1 so make una put una body for one place ooo........... Our news reporters don increase yesterday from 56 to 82 as all this people dey invincible just like me and dem go cover all areas for this school so if u do any how before u go know u go see ur self for here life, especially our lecturers and all these cult boys make una watch una back cos we don ready for una............... AUCHIPOLY EDO/STATE MUST BETTER. NA ME THE OTOTA OF AUCHIPOLY D ONOGIE OF AUCHIPOLY D OTARU OF AUCHIPOLY AND D EAGLE EYE OF AUCHIPOLY, Nai dey give una dis news, abeg make I go see my honourable dean of students una bye bye.........
Posted on: Thu, 28 Aug 2014 08:18:43 +0000

Recently Viewed Topics




© 2015