Take life simple.. Remember, that blackberry you used to oppress - TopicsExpress



          

Take life simple.. Remember, that blackberry you used to oppress then is now everybodys common phone. *You used your Camry to Buga, now boys use Camry to do taxi. *Before u dey use your plasma screen dey swell.... now dem don dey use am watch ball for buka, *B4 u dey use your ipad dey swag... now ipad na heavy load to carry comot from house, *B4 u go dey use brazillian hair dey form big girl, secondary school student don dey wear am troway. *B4 u dey go vacation 4 Uk dey talk pass yourself, now boys don dey buy 1st class ticket dey enta london just to go lick ice cream and watch Chelsea match.. BOTTOM LINE: No dey over do like say dat tin no go reach another person hand, All na vanity, e dey fade like Aba Jean.. No 4get say tortoise car na big man motor b4 o.. Notin wey come wey no get expiring date, even the life u have na borrow you borrow am.. Humility na the best choice!!!gv it a trial now!
Posted on: Sun, 30 Nov 2014 11:23:38 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015