Tori For Town: One 26years old woman, Crista Engles bin die from - TopicsExpress



          

Tori For Town: One 26years old woman, Crista Engles bin die from the accidental shooting of gun by her 3years old son for dem house, wen she bin dey take care of her 1year old daughter. According to NBC News, one 3years old little boy bin kill im mother after im bin find one loaded semi-automatic handgun inside dem house wey dey Tulsa, Oklahoma day before yesterday November 25th. The woman mama wey dey also live for the same house, bin no dey house wen the horrible accident bin occur, she bin just reah house to see the 3 year old and 1 year old children dey covered in blood and dem dey cry, this nah according to Tulsa police. She bin find her daughter deadbodi beside her children and bin think say nah intruder bin kill her wey she bin immediately called the police.As dem come investigate, the police find out say nah the boy bin accidentally shoot the gun & unfortunately im mama bin dey the front of the gun. Police talk say wen dem bin visit the home, dem see plenty guns dere. The woman husband masef bin no dey house wen the incident bin occur… Bigmo (@bigmoNaija) wan know wetin you think for inside dis matter? #UnaWakeUpShow #ToriForTown #TearRubberWeekAndMonth Twitter & Instagram: @WazobiaFMAbuja Tel: 0709-2222-995 wazobiafm/abuja995
Posted on: Mon, 01 Dec 2014 05:30:50 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015