U be 18yrs old n ur sugar daddy na 7oyrs n u still call him BABY, - TopicsExpress



          

U be 18yrs old n ur sugar daddy na 7oyrs n u still call him BABY, my sister d man na ur ANCESTOR. U claim say u chop rice n stew, but u come vomit fufu and egwusi soup, omo u be MAGICIAN? U claim say u nor dey cheat on ur girl, yet u dey receive different calls 4 her presence, my bros, u be CUSTOMER CARE AGENT? U snap diferent pix wit different cars wen nor be ur own, wetin self u be MECHANIC. U ask a gal wot she wants, she tell u Money n u become angry, were u expectin her 2 say Wisdom and Understanding? Ur babe get F9 parallel 4 WAEC, she still dey ask 4 Brazilian Hair of #150,000, where she want fix am? On top of dat Coconut Head? Ure 6.5ft tall, u still come wear 6 inches high heel shoe, u want go Moon? U get different gals pix 4 ur fone yet u expect ur gf 2 believe ure nt cheating..bros,u b Photographer? He gave u an engagement ring for ova 5yrs, he neva still marry u, my dear sis, u be LORD OF D RING abi ur finger na KEYHOLDER? U dey read dis post n u nor laff, abeg wetin self u be WITCH? U read dis post finish u nor comment, haba! U be BAD BELLE? Una JOLLICIOUS EVENIN JOR.
Posted on: Tue, 21 Jan 2014 18:53:47 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015