• U dey carry ur girlfriend go club; after u marry her finish u - TopicsExpress



          

• U dey carry ur girlfriend go club; after u marry her finish u wan stop her frm goin to club. My broda u think say miracle fit happen? • Ur girlfriend dump u for rich man u say she b gold digger, bt ur sister do d same to anoda perso u giv testimony for Church say, na grace of God. Bros park well!! • Your babe get F9 parallel for WAEC, she still dey ask for Brazilian Hair of #150,000 . Abeg where she wan fix am?, on top that coconut head? • U have 8 tribal marks, stretch marks scattered all ova ur body yet u still want a tattoo...ah! my friend; u be zebra?!! • U are 6 feet tall, u still com wear 6 inches high heeled shoe... shey u wan whisper to God? • U dey snap inside different type of cars yet u expect ur man to believe say u no cheat. .aunty, u be mechanic? • U gather different gals picture for ur fone & yet u xpect ur gal to believe say u no cheat.. uncle, u be photographer? • He give u engagement ring for over five years, he never marry u, my dear, u be lord of d rings? •you dey pay your babe wey dey university school fees and yet u never write JAMB, U be scholarship board? •U are 18yrs and ur sugar daddy is 70yrs old and u still dey call am BABY, my sister, he suppose be ANCESTOR. •Your babe is licking ice cream...ure drinking pure water...pls guy Are u diabetic? •U claim say u eat rice and stew, but u come vomit fufu and egwusi soup. Omo u be magician? . Na joke o....Read and pass on to friends make dem laugh too...
Posted on: Wed, 10 Sep 2014 22:51:36 +0000

Recently Viewed Topics




© 2015