UNIBEN PIDGIN NEWS UPDATE : as una read dis news, now better - TopicsExpress



          

UNIBEN PIDGIN NEWS UPDATE : as una read dis news, now better better things go dey come una wey oh, una nor go lack again,and also una go day read and understand.. una happy weekend oh, dis week way don dey end so go bring more open door 4 na oh. And also d new week wey una one enter go bring una JOY. NOW D NEWS PROPER : 26-Days 2 exam oh,abeg if u never start jacking [reading] may u start oh ,becos no time. UNIBEN don get new V.C [ Vice-chancellor] ,he name now PROF. F.F ORUMWENSE , from mechanical department b4 them #vote am in,he first be #rector b4 for #usen poly and also currect Acting Dean of engineering faculty.... Prof. F. F orumwense go enter office 1st of december 2014.. 4 now,he now #V.C -ELECT. Latest V.C in town ,we say congratulation. Out going #V.C , PROF. G. O oshodin don try well well oh 4 uniben,Some of d things wey our out going V.C DO NOW : [1.] Painting of Life science and physical science [2.] Massive Employment for the various people and some departments [2i]. Security men and women. [2ii.] Young Lecturers. [2iii.] Health workers. [2iii] bursary unit[workers] [2iv]. Student affair unit[workers]. [2v]. PORTERS [3]..he provides security 4 uniben students...... Uniben security come strong.. [4]... He provides Work study 4 students wey one work and still day go school .. [5]... Our Hostels don day look sweet small small ,because Massive renovation don day go on 4 ogbowo and ekhuwan campus... [6]... Things 2 many.... We one beg dis our new V.C way he work pass our out going V.C ,BECAUSE AS OLIVER TWIST U ASK 4 MORE. Yesterday Now PROF. Sunny ONOHAEBI Gives his INAUGURAL LECTURE.. See as main auditorium full remain ,chaiiii , now really Good man.... See big men and women full there like me and my news crew,senator roland owie ,and many more. prof. Sunny onohaebi say thank u 2 everybody wey come,.... We one beg S.U.G MEMBERS [ Led by ifidon ] wey dem unite UGBOWO AND EKEHUAN CAMPUS 2GETHER.....becos ekehuan campus students nor they ugbowo campus and ugbowo campus people nor dey go ekehuan , abeg e nor make brain abeg because nor be everybody wey day ugbowo campus know road [no] 2 ekehuan campus.....abeg make una come up with things we go bring d 2 campus closer.. Protect rocks benin city yesterday over the arrest of APC FACTIONal speaker and some member of Edo state House of assembly , by EFCC. Jonathan nor play politics with chibok Girls - APC. Fayose don enter as Governor of Ekiti state and workers way dey on strke b4 ,don call of their strike. Buhari picks A.P.C #27.5 MILLION Nomination form. Your criticism dey baseless,jonathan tell Buhari. 6 A.P.C lawmakers don defects to P.D.P 4 ekiti state. Ihedioha don declares for IMO STATE Governorship race. I nor go contest 4 A.P.C presidential ticket - gov. Oshiomole. BUHARI/FASHOLA ticket go better 4 A.P.C - bisi Akande. Tell nigerians truth about our economy - gov.fashola tell F.G. Olamide don release his new Album cover yesterday. 2face say he nor get fixed fee for shows. I go fit charge up to #10 million 4 a collabo - Wizkid. Me and my news crew go soon start 2 day sing oh,so that we go day collect like 5million 4 just collabo..just like wizkid.. NFF don sack stephen keshi. Minister of sport don summon NFF Over foreign coach. NFF Dey eye pinto,pekerman as nigeria coach. Musa ,nigeria go fit still qualify. Nigeria vs nambia [ladies]. Arsenal vs Hull City.4pm Man city vs Tottenham 1:45pm. Crystal palace vs chelsea 4pm. Barcelona vs Eibar 8pm. Levante vs Real madrid 4pm. Sunday fixtures : Q.P.R us liverpool 2:30pm. Atletico madrid vs Espanyol.12pm. Monday: west brom vs man utd 9:00pm For u 2 see dis day nor be ur power oh,now by Gods Grace oh.. Put God first 4 everything u day do. Dis new go come una wey next time,dis page, make una remain bless.
Posted on: Fri, 17 Oct 2014 06:03:06 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015