Una Goodmorning o! E don tey wey me and una gist abi? No worry - TopicsExpress



          

Una Goodmorning o! E don tey wey me and una gist abi? No worry we go soon gist now, just wait. Meanwhile I hear say na Prof. Sen. Ben Ayade Win for the PDP Governorship primary school election Wey bin happen inside Calabar yesterday But wait first o Wetin just surprise me na the kind gap wey hin give other people wey follow am drag the class captain for the primary school election E come make me dey wonder weda the man na Professor of Mathematics? Anyway sha e no concern me I dey just think aloud Meanwhile I take God name beg you Make you no come follow me dey quarrel this morning o Cos I no know weda na your Papa, Uncle, Husband, Boyfriend or Inlaw lose the election so o! Me na just joke I dey o! I no be one of the delegates o!
Posted on: Tue, 09 Dec 2014 07:45:22 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015