WAOW CANT BELIETVE IVE STAYED AT HOME FOR FOUR MONTHS AND ITS - TopicsExpress



          

WAOW CANT BELIETVE IVE STAYED AT HOME FOR FOUR MONTHS AND ITS STILL COUNTING I miss (those security men wey dey feel like say them b JTF.. ) It hasnt been easy I miss convocation arena (wey Humanities and Education students dey sit down look who dress well and who no dress well come school) l miss night class (guys toastinp, girls agreeing, thieves thiefing, 90% sleeping) l miss melly chicken (where ofrima girls ready buy only 1 coke sit down press fone 4 2hrs) i miss those my Economics lecturas (wen dey teach like say na dem get my head 4 me esp. Mr folks) i miss my fellow Economics mate (wen e b say if lecture na by 9am, 6am them don reach class) i miss d bus conductors (wen no dey ever get change once dem drop u for upth, Abuja, or choba park. I miss Alakiah oo!! D hot chicks zone. (wen girls go wear bumb short waka till day break) i miss my hostel Somiella 2 apartment (where girls go just day form, sitdown outside ping til day break, if u no get generator for d compound na u poor pass, were my caretaker Osaze go form say na him b landlord whereas go day use our money to tay pomp water day toast babes.) i miss my room mate and he friends Tega, david,Justice,Sly,Efe,anderson,Noble,Kinzo,Fosu,chidi etc (wen e b say a day to exam them sitdown day play ps2 game say no b my reading na who pass exam na e know book pass) i miss david (wen e b say if na him day win 4 ps2 game na there he go day say he day play game of immortals.) Lol but if he day loss no just near am. Hmmmmm i miss my neighbor Justice na only IUPAB,(International union of pure and applied beans) IUPAES (international union of pure and applied Egusi soup) IUPAAS (Internationa union of pure and applied) Afang soup) IUPAS (International union of pure and applied egusi soup) na only those ones he day cook. I miss Anderson (wen e b say if day break he go day ask me daddy wat are we eating as if say na me b e papa) i miss tega (wen e b say if i day kitchen day cook he go day call me e wife) Hmmnmmmmm.... I CANT JUST WAIT 4 ASUU TO CALL OFF THE STRIKE.
Posted on: Mon, 04 Nov 2013 07:43:08 +0000

Recently Viewed Topics




© 2015