WETIN DEY KILL PERSON FOR AMERICA TOO PLENTY. For Nigeria, na - TopicsExpress



          

WETIN DEY KILL PERSON FOR AMERICA TOO PLENTY. For Nigeria, na only weeeeensh/enemies and Boko Haram dey kill person. Even if you get car accident, na weeeensh. Even if the man died at 89 years, the enemies have succeeded Yes oh. You see eh, we for Nigeria believe say dirty no dey kill African Man Yes. If you done stay village, you go see fisherman set yansh from corner of canoe, drop like two big gedu of kaka (poop, excrement) and ou go observe say the water dey flow towards you. Yet you go use one had bail/push the top of the water go one side then deep calabash or bucket enter the water fetch am go house. You go first jump enter the water swim small sef and drink enough, then carry that water go house and them go drink am and use am cook. Dirty no dey kill African man If belle pain pikin after drinking this water, BONE! Na weeeensh kill am. Why the dirty no kill him senior brother and sister? In fact na ogbanje. To go house (to meet his fabled mermaid mother) dey hungry am. But really aside this new Boko Haram yeye and bad roads and old vehicles and lack of seatbelts, na very few things dey kill Nigerians....SUDDENLY. But America hmmmm. Make I no talk of people wey just like kill people before them kill themselves. Make I just talk of natural events 1. SINKHOLE. You know say a you dey waka or drive or sleep, your full house go fit just fall enter deep pit wey dey under you. The thing go be like juju something. ground go just open swallow full area. God abeggooo. 2. Earthquake. That one una know am since. Na this sinkhole new for me eye. 3. Mudslide. Mud wey we take dey build house for village. For America, the thing dey be like avalanche. As person dey him house, Mud go just rush come fall the man house and bury him and him family inside. The full area like Enerhen junction go just scatter like say them fight war and use bomb. You go fear FEAR. 4. You done see hurricane abi? Na woman name them dey call them. Some dem dey call am Sandy, some na Irene. No be small amount of people dey kpoof (die) and property dey destroy. 5 Tornado. Urhobo people dey worship this one junior junior junior brother wey demdey call AZIZA (whirlwind). Here, some tornadao wey fit carry like that LION BUILDING from Lagos mainland go like Lekki then bring am come drop for Ebute Meta dey. 5b. The tornado wey be fire dey too. Na so fire go dey turn round and round. Who no believe say Hll Fire dey, make he try google fire tornado. I see am for news as e dey happen last year for empty area for America. As I dey look am for TV, me feel say I see Devil for the center. I repent sharply and born again for like two days. 6. Flood. I still never learn to dey look weather report until last two weeks as I say make I tune radio naim I hear those taking the so so and so road, please go back TO AVOID DROWNING. I say shuoooooo. Na there me dey go oh. SHUOOO. This small rain? E be like joke. 10 minutes later, wiper no fit wedge the rain. And yes dem use helicopter comot people for that area and see many many new motor as water cover them. Now them go get to sell those cars as damaged cars. 7 Heat Wave. Una think say Nigeria sun hot abi? Try ask people for Texas wetin be heat. Heat for America dey kill person. If you no get AC you fit kpoof. 8 Blizzard. This na snow wey go on and on. But even normal snow can kpoof you well. Na inside freezer people dey stay for winter....wait....e cold pass any freezer i see for naija. If you pour waterfor ground, na frost u dey see in ten seconds or thereabout. You stay outside, you turn ice fish. 9. Landslide. As you dey, ground go begin dey shift and full house go fall follow the ground. 10 I done tire so make we no bothr with Tsunami, cyclone, etc etc. Now my point be say God bless Nigeria well well. He do the weather here like as Landlord dey arrange the side he want to stay for building. God no put all this weeeenshy things wey go finish us. We wake up, sun must shine at set time. For like Siberia, 6 months dem never see sun well. some places like months na darknes then months na light. You no go know when to go sleep I sure. Na shirt we wear for rainy season we dey wear for Harmattan. You try am for US you die well. As summer done show so, na so we dey go buy cloth again. The thing really be say na only we dey weeenshy ourself. Na we be we own earthquake and typhoon. Okay see America now. Na California dey feed the nation pass unto many farms. No be small drought want to finish them. Rain no dey gree fall. Nigeria, just plant your seed and God done set him irrigation for us. So why we dey do like this? Why our politics and religion no fit be like our soft rain and mild harmattan? Why we no fit be like the lovely lovely LOVELY NIGERIAN WEATHER and love ourself???
Posted on: Tue, 20 May 2014 07:48:43 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015