Waow cant believe ive stayed at home for four months and its still - TopicsExpress



          

Waow cant believe ive stayed at home for four months and its still counting .... I miss (those security men wey dey feel lik say dm be JTF ) Mehn...it hasnt been easy,I miss CONVOCATION ARENA (wey Humanities and Education students dey sit down look who dress well and who no dress well come school) I miss MAMA ABUJA ( kai! That woman food no be here @fair prices sef) I miss NIGHT CLASS (guys toasting,girls agreeing,thieves thiefing,90% sleeping I miss Humanities and Basic Unit o (where boys dey always go find LCS and Basic chicks) I miss D n D and Melly Chicken (where Ofrima girls ready buy only 1 coke sit down press fone 4 2hours) Hmmmmm.....cant imagine, no more early morning classes?no fixed classes and no test, I miss them all,(those my lecturers wey dey teach like say na dem get my head for me,com dey giv assignment like die!.....I miss dem too. I miss the bus Conductors o ( wey no dey ever get change once dem drop u for Abuja OR CHOBA PARK .. Eheeiiii...!!!RUSHING OF BUS!...I miss u oh(Ive forgotten my running and high jump skills, no UNIPORT bus to practice dem again) I miss Aluu oo! Pritaso and Hilton 2 Ajebo chicks, Sunnas (where Aluu girls ready whr boom short come buy N200 food, yet na dem form pass) I miss Denross Guys; Igbo and Sk centre! I miss those Hilton2 boys sitting in front of Abu shade I miss UNIPORT LIBRARY (while you dey concerntrate on your books,other students dey concerntrate on your bag) I miss SOLUTION TREE(Relaxation spot for those wey no dey attend classes) I miss those photographers; wey tink say na evryday I go dey snap passport I miss that short calabar pastor with big shoe and radio wey dy preach for choba junction, e can dance eeehn! I miss dem all babes,secret admirers,lover boys,aristo gals,&loved ones....I miss sitting at the faculty, class blocks,strolling around campus,quarelling,and gossipping. ...I miss the ALUTA SPIRIT...I miss UNIPORT...proudly a Unique Student...
Posted on: Wed, 06 Nov 2013 07:41:14 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015