When I look sotay how beta Baba God be a com hala read psalm 23 - TopicsExpress



          

When I look sotay how beta Baba God be a com hala read psalm 23 for pidgin english: 1. The Lord na my shepherd, i dey kampe. 2. E make me sidon for where betta dey flow and come put me next to stream make mai bodithermacool. 3. E panel beat mai soul come spray am white come dey lead me dey go through express roadof righteousness sake of Hin name. ... 4. Walahi!, if I waka pass where arm robber, 419 and juju people boku, come even join boko haram reach valley of the shadow of death sef, mai body dey inside cloth. Your rod and staff nko ? Na so dem dey like back bone dey comfort me. 5. You don prepare good food on top d table make I chop. All mai enemies dey look waa waa. You rub me for head wit vaseline intensive lotion. my cup na River Niger wey overflow hin bank. 6. True true, betta life and mercy go gum my back till I quench. And man pikin go tanda for God house from lai lai to lai lai. Amen Amen & Amen GOD ALMIGTHY NA YOU BIKO AMEN
Posted on: Tue, 28 Oct 2014 03:44:42 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015