When I was in school... Maths was like the hardest shit - TopicsExpress



          

When I was in school... Maths was like the hardest shit ever...some bin know am..some bin no know am. Me I bin no know am. I try try try sotey my head kon dey pain me. Na eem I tell myself Shuuu On top wetin naa!?..you wan kii yourself?!, tekam suffri oo Baba Na eem I calm down..jejely go copy Silas own then for exam we ruggedam any which way....me and Okon. We knew we were made for something else no be to be efiko or scientific guru..Na money we dey find and we know Wetin we fit do without making our brain pain us... (We knew our strength... But weve gotta pass maths to get on to the next level in school...so we tried harder to make it.) When we go write jamb ....we check brochure sotey the jamb brochure tear..we no want course wey get maths inside ..and we no want dey unrealistic choose course wey our papa no fit pay the school fees for where we no get leg. Ahh oboy...we know wossop nau. (Knowing for a fact say .***No be by course we go take get our kind Job...Na by God Power.). Wait!! Abi you doubt God???!! No try am o! As a sharp guy Na...when I kon enter yunivaasiti ..aah o boy! I sharp pass knife,knowing where I from come. (I never let schooling interfere with my education) I been different from many people die...my course just been dey gimme boost,drive,ginger to know for myself if they no tell me..cuz Na yeye CDL book like dis wey don outdated dey been take dey teach us o.. Book kon be abstract from the real world of business for outside. Shuuuh!!! Nna mehn I no dull o! Na eem I start to dey read on my own,dey study into Wetin I won be and venture into,dey observe,dey ask questions, dey build up my #Skills. When I finish school...with prayer and fasting and seriousness.. Dey dey craze ma no get Job! I was already loaded with what some of their staffs sef no been know. Now I be #TheBaddoOfRadio Nigerian Broadcasters Merit Award Nominee for Outstanding Radio Program Presenter . #NBMAwards2014 Now I be the #Baddest @Dayo_Skills a.k.a. #MrLeggo!!! Somebody shout Hallelujah!!!!!!!!!!!!!!!!!
Posted on: Thu, 04 Dec 2014 07:53:46 +0000

Recently Viewed Topics




© 2015