* You dey do opening prayer for Night Club. - Na God go slap your - TopicsExpress



          

* You dey do opening prayer for Night Club. - Na God go slap your mouth. * You come back from Dubai come dey speak British accent. - Na rat go chop your mouth * Youre a house boy you come dey play Rick Ross - I am the Boss. - 4 where....?? * You dey add water to egg say e go plenty when you fry am. - Why you no add yeast join am...Stingy man. * You no go university, and you dey find your name for National service posting. - Na yeye dey worry you. * House dey burn, you wan use gas do fire extinguisher - Hahahahaha....You for use kerosine instead. * You dey talk say Kuborlors music dey inspire you - unto which level!! or abii you wan go naked. * You carry candle dey look for where fuel dey smell from. - continue you go soon see am * You call MTN to tell dem sey your free browsing has stopped working. - Lolzzzzz.....mad man. * When pastor talk say Do something crazy for the Lord You come carry church offering run - na who wan chase you?..... * You read dis & u no send am when you smile finish - na only you dey Stingy to the last... - 4ward am jor and put a smile on your face no matter the condition.
Posted on: Wed, 20 Nov 2013 22:36:11 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015