You used blackberry to oppress now dem dey use BlackBerry dey run - TopicsExpress



          

You used blackberry to oppress now dem dey use BlackBerry dey run fone boot biznex. *You used ur Camry to Buga, now boys use Camry to do taxi. *Before u dey use ur plasma screen dey swell.... now dem don dey use am watch ball for buka, *B4 u dey use ur ipad dey swag... now ipad na heavy load to carry comot house, *B4 u go dey use brazillian hair dey form big girl, secondary skul student don dey wear am troway. *B4 u dey go vacation 4 Uk dey talk pass urself, now boys don dey buy 1st class ticket dey enta london just to go lick ice cream.. BOTTOM LINE: No dey over do like say dat tin no go reach another person hand, All na vanity, e dey fade like Aba Jean.. No 4get say tortoise car na big man motor b4 o.. Notin wey come wey no get expiring date, even the life u have na borrow you borrow am.. Humility na the best choice!!! BEWARE OF PRIDE--
Posted on: Sat, 04 Oct 2014 09:55:59 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015