i salute all my ijaw brodas and sister wel wel.our elders say who - TopicsExpress



          

i salute all my ijaw brodas and sister wel wel.our elders say who no go.no know.my people sumtims wey ijaw youth go do sumtins pple go dey blame dem.sum pple go even talk say wetin dey worry dem there no do Amnesty4dem.no b everybodi do Amnesty o.1week ago my people i go stay village@opuama&polobubor.my pple b4 wey i dey town i fit say those people dey enjoy.make we talk truth make devil shame.dis pple dey suffer beta suffer.no good water to drink or baf.na portoporto water dey every were.the worst tin be say d community light sef no dey steady at times six months sef light neva dey despite of all d plenty plenty mosquitoes.what abt the jobless youth dem.there plenty fool ground.my pple those pple wey we call our leaders wetin dem dey do.abi there no knw wetin d ppel dem want.abeg our leaders we beg una mke una use una church mind.bcuz if u die na dat place wey u for com.na there they go still carry you go.this mesge na to my ijaw leaders
Posted on: Fri, 14 Jun 2013 08:49:32 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015