miss Photo stand thats where poly chicks have their RED CARPET, - TopicsExpress



          

miss Photo stand thats where poly chicks have their RED CARPET, showcasing Aba and Ok cloth,lol. I miss Guiness spot where everybody de fear if the next man na fraternity man lolz. I miss ceremonial ground, where we go de read 4 night class students go shoot gun and other students go leave their books wey them get the next day, jump window and next 2min hall wey full go empty.. lolz. I miss that okirika man wey de beside Sharon fastfood, where babes buy bend down select de form, ... my aunty sent it from jand for me #shakng my head# I miss Umuerim @ night where u eat roasted fish, plaintain, akara..Etc. I miss Johnceilia, oboy! Where guys go carry their chicks come chop cheap but good food I miss poly shrine wey dey Umuerim wey you go de come back from school you no go see road pass because them de road! I miss axe men and baggers fight, lie lie people, 10-0, 20-2, yet we no go even see blood for ground talk more of 1 deadbody, na 4 sky una de kill them? lolz I miss STATE light people, wey de always carry charger waka up and down inside school. I miss south africa, where if you de pass you go don comot your sim card from your phone, put am for socks,hold the phone for hand. I miss 1000 capacity hall where if we de write exam we de sit 7 per desk and no turning of neck (Reserve my comment). I remember pop corn stand, wey if you come late, you go use ur hand hold waterproof,make them serve you popcorn. Kiaaa!, i no 4get ishage ri i gwa (big fufu and 2 big meat, choi!!). I miss fidelity and Access ATM where guys go de queue de check chicks wey fine and get shape and the ones wey no fine..and Ill not also 4get hostel A where chicks de hang 4 hostels balcony dey check guys wey enta with latest car and well loaded... I miss school road 4 winter suite where guys and some chicks de come club, guys go pass chicks... if i continue i no go finish! I miss ihiagwa market. Make i end am here jooor........i miss fedponek like maddddd joor... Greatest Nigerian student !!!
Posted on: Mon, 04 Nov 2013 08:47:21 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015