na for lasgidi here una 4 day embrace stars na.if u go warri, - TopicsExpress



          

na for lasgidi here una 4 day embrace stars na.if u go warri, agbor dem!.u go knw wetin i day talk. u c eh? for example now, shebi kcee go unilag girls dem hostel 4 hin buffday? as a surprise abi? dat 1 na for lag oooo, wey dose girls day shout, day scream!! make i tel u wen kcee go warri with flavour say hin wan go surprise the girls wey day dere hahaha!!,na dem gan gan day introduce themselves as nobodi evn kon meet dem for where dem day 4 lyk 20mins lyk dis: kcee: ah una no knw me?(no response) (5minslater) flavour: una no knw dat guy wey sing limpopo?(no response) (10mins later) kcee: me wey day wyn my waist lyk una(girls) (no response) (5mins later) ah! flavour: no wori kcee make i tell dem flavour: ah una no knw diz guy? hin name na kcee na him sing limpopo ........(no response) nd u c, hin wyn hin waist gaaaaannn 4 d video oooo!, nd u c na me teach am ow 2 wyn ooooo, me my own my name na flavour i b musician self buh u c i neva sing any song, I jst day kum up!! make una abeg ehn? lyk my song if he kum out abeg!!! ehn? bcos i knw say una day kill person career for here chai!! kcee: (consoles flavour and says)but dat my song jst kum out na, e neva tey at all!, ehn?? ok, make i sing am 4 una, mayb una go remember!, oya limpopo babi babi go Limpopo, oya limpopo babi babi go limpopo......... students wey day dere jst pursue both of dem komot 4 dere, na kcee and flavour kum dey shout ah!! God go judge una oooo!! una wey day kill person career!!!. dat day ehn? no b small thing ooooo!!! make sure u like diz!
Posted on: Tue, 03 Dec 2013 11:56:07 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015