ogbonge news 5:30pm naijafm 102.7 friday 23rd january 2015. by - TopicsExpress



          

ogbonge news 5:30pm naijafm 102.7 friday 23rd january 2015. by prof headlines: -wi oga presido don tear give dos wey dey owe wi contri import duty money ontop rice -wi independent national electoral commission don tok say dem no go ever shift di day wey wi go do dis wi general election-dem -de don crown new king for saudi arabia after dem down-load di former king finish -one ogbonge english football club don sign one of wi naija ogbonge woman player into dia women football club -one of wi naija-british actor don dey yan with anoda ogbonge actor to feature for one of ein new film wey go soon come out ogbonge news 5:30pm naijafm 102.7 friday 23rd january 2015. by prof ‘’de say, no bi di eye, wey de take borrow money, de take dey pay-am back-o’’ and’’ okro, no dey tall pass di person, wey won pluck-am’’ Wi oga presido, Goodluck Jonathan, don tear, and yan today, say, all dos wey dey owe wi contri, import duty money ontop rice, say, dem must pay, no-mata how high, di person bi. E tok dis word, weyn ein dey use ein peppe-eye take dey give order to dos wey dey import rice enter wi contri-naija. E say, e no see any reason, why ein go allow dis group of pipo wey dey import rice come wi contri, to dey hold wi contri-money-hand, anyhow like dat. ------------------------------------------------------------------------- ‘’de say, if calabash don belle-full, di cover go must follo lick oil too’’ Meanwhile, wi oga presido, Goodluck Jonathan, don approve di release of N26 billion for farmer-dem, to use do farm during dis 2015 dry season for inside wi contri. Oga Jona, offload dis infomate today, during di occasion of di program wey de call AGRIFEST 2015, wey de do for Abuja, to mark di four years of serious and heavy reform-dem wey dis govt don do ontop agric-mata inside wi contri-naija. Wi oga presido, also say, dis money wey ein approve so, na to also show, how ein dey happy-reach, about di way wey wi contri-side farmer-dem, take welcome dis agric transformation plan, wey de take follo produce food pitiki inside wi contri, during dis period, wey con poshu hunger plus poverty comot from plenty of wi contri pipo-dem body. E say, e also give dis money, to fit helep make wi farmer-dem dey do three farming season inside every year for wi contri. insert………jonathan Wi oga presido, Goodluck Jonathan, con yan say, wi contri-naija dey proud of naija farmer-dem as dem follo create plenty thousands of job-dem give wi youth-dem through agriculture, and na wetin good for us to always dey celebrate. E say, dis ein govt also plan to develop 750,000 young farmer-dem soon and promote agriculture inside wi primary and secondary school level-dem. ------------------------------------------------------------------------- ‘’de say, pikin wey don bring head come out, under ein mama kokose, e dey hard to push back-o’’ Wi Independent National Electoral Commission (INEC), don tok say, de no go fit change dat February 14, date wey wi won take do dat wi presido election and con deny some kyn report-dem, wey tok say, e bi like say, de dey plan to change wi election date, e say, dat word na serious ofian. Na di chairman of di commission, Prof. Attahiru Jega, nak dis tory today, inside one chop-tok, wey INEC organize inside Transcorp Hotel for Abuja, to take advise pipo against any oyangha-yangha, during dis wi election-dem. Oga Jega, say, di commission neva sidon one day, to even take second eye look into dis election date-mata, not to even tok of say, di plan to won shift any election date. Di inec oga kpata-kpata, con tok say, e even dey wrong for pipo to dey blame di commission, b’cos of pipo wey neva gree come to con collect dia permanent voter card-dem, as de don produce di card-dem and send-dem to all di difren-difren collection point-dem across di contri. Oga Jega, wey refuse to tok about dat word wey wi national security adviser, Col. Sambo Dasuki, tok e neva too-tay say, e suggest make de postpone di election make de for allow more pipo to collect dia pvc-dem, also tok say, di election-dem go shele inside 155,000 voting centre-dem across wi contri-naija. ------------------------------------------------------------------------- Meanwhile, INEC don announce today, say, de don recover di total of 983 permanent voter card-dem, wey some bad-pipo bin snatch during di distribution exercise wey dem do for Orhion-mwon local govt area of Edo state last year. Na di state resident electoral commissioner, Mr. Mike Igini, offload dis informate during di meeting wey ein do with all dos wey get hand and leg inside election-mata, for Benin. E explain say, dis card wey dem recover-so, dey among di 3,661 PVC-dem wey some pipo tiff inside di 18 polling unit-dem wey dey dat local govt area. E also say, di commission collect di cards after de receive one no-number phone call “anonymous calls” wey promise to return-dem. ------------------------------------------------------------------------- Di oga director ontop informate-mata for wi naija army defence headquarter, Maj-gen. Chris Olukolade, don announce say, some internet tiffi-tiffi jankoliko-pipo don break enter di website of wi army defence headquater. Oga Olukolade, wey yan thru electronic e-mail, today, e say, de discover say, di pipo break enter dis site, wey bi, defenceinfo.mil.ng, today early mor-mor. Meanwhile, e say, de don re-arrange di defence headquarter informate blog site, so no yawa. E say, from investigate, de find out say, dis pipo wey bin won do dat thing, enter di website to won find out how wi army take dey run di plan dem wey de take dey deal with dis boko haram jaguda group. Oga Olukolade, say, de don put off di account of one, Ima Sadiq wey bin dey pose as di hacker, and de don take full control of di site. ------------------------------------------------------------------------- ‘’de say, na who carry cripple go bush go fetch firewood, if e no take time, na-im go carry-am with di firewood come house’’ Wi national security adviser, Mr. Sambo Dasuki, don yan say, wi contri-naija no need di help of United Nation or African Union soja-dem, to take fight di boko haram jaguda group. E say, wi contri-naija plus ein nebo contri-dem, Niger, Chad and Cameroon, get di soja-power to quench dis ugbarugba group comot from ground kpata-kpata. Oga Dasuki, tok dis word inside one program wey de do ontop BBC. E say, though de go discuss dis mata of international support against dis jaguda group, inside one African Union meeting wey de go do later dis month. E say but, ein believe say, di meeting wey wi contri-naija don do with ein nebo contri-dem, Niger, Chad plus Cameroon, dis week wey just dey comot-so, e hold ground to di point say, dem fit brush dis boko haram jaguda group comot from ground kpata-kpata. ------------------------------------------------------------------------- Di national youth service corps for Kano state has don offload assurance give corps member-dem, wey go like to work as ad-hoc staff for INEC during dis wi February election-dem, say, de go give dem correct kpamgba security. Di state NYSC coordinator, Mr. Sanusi Abdul-Rashid, wey offload dis assurance inside Kano today, say, di national headquarters of di NYSC go do collabo with difren-difren security agency-dem and INEC to make sure de provide correct security for dos of dem wey like to follo participate inside dis exercise. E also tok say, na plenty corps member-dem don show interest to participate, but di state NYSC neva know di exact number. ------------------------------------------------------------------------- ‘’de say, belle no dey sweet old-man, reach di level wey e go take carry ein head put for ground, for small-small pikin-dem, to begin use ein ear, dey play di game of ayo-o’’ Di All Progressives Congress (APC) don squeeze face about dat bad adverts wey some body take spoil di name of dia presido candidate inside di 2015 presido election, Gen. Muhammadu Buhari. According to di tory wey comot from di mouth of di national tok-tok-person for APC, Alh. Lai Mohammed, e describe dos recent advert-dem wey di governor of Ekiti state, Ayodele Fayose, take paint di heleth condition of dia candidate, as some thing, wey no follo obey di peace agreement wey all di party-dem sign, e never too-tay. Oga Mohammed, con deny one tory wey tok say, na APC, send some of dia pipo to go cause ozighi during wi oga presido rally for Katsina and Bauchi, e say, na PDP-pipo fight dia sef. cue in (lai/violence) Oga Lai Mohammed, say, ein party di APC no go accept dat advise, wey wi national security adviser, Col. Sambo Dasuki, give for London, say, make de postpone dis wi 2015 election-dem, to allow dos wey neva collect dia PVC-dem. cue in (lai/postponement) Wi newtory-person, Immanuel Odeyemi, katapot report say, all di effort-dem wey ein make to get PDP own side of dis tory, e no succeed, b’cos all di call wey ein make to di national tok-tok-person of PDP, Olisah Metuh, di response bi say, di man don switch off ein phone-dem. ------------------------------------------------------------------------- Di Onitsha chambers of commerce, mines and agriculture, don tell wi oga federal govt say, make dem try di grave yard of late, Dr. Nnamdi Azikiwe, wey some other of wi govt-dem don abandon since over 17 years ago. Di presido of di chamber, Dr. Tim Anosike, wey give dis advice for Onitsha, for Anambra state, describe di delay to complete di mausoleum as show of disrespect for di late Azikiwe, wey bi wi naija first presido. insert………..anosike Di presido of di chamber say, if govt fit finish to complete, di mausoleum, e go attract tourist-dem, to Dr. Nnamdi Azikiwe, wey everybody sabi as `Zik of Africa, wey bin dey great, not only for wi country, but for Africa. ------------------------------------------------------------------------- ‘’de say, di animal wey hunter don kill, put for inside bag, e no dey hard-am to butcher-o’’ Di govt of Bayelsa state, don offload assurance say, dem go complete di multi-billion cargo international airport, wey de dey build now, inside di state, and ready to use-am before di end of dis year 2015. Na, Mr. Lawrence Ewrudjiakpor, wey bi di state oga for work and infrastructure development-mata, nak dis informate during di time wey ein go inspect some of di project-dem wey de still dey build-now inside di state. E say, dis airport dey necessary to attract more investment-dem to make industrialization plus tourism to tranga chiim and even helep gada plenty put inside di pocket of Bayelsa state. insert……..lawrence -------------------------------------------------------------------------
Posted on: Fri, 23 Jan 2015 20:17:43 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015