ogbonge news 7:30pm naijafm 102.7 thursday 16th october 2014.by - TopicsExpress



          

ogbonge news 7:30pm naijafm 102.7 thursday 16th october 2014.by prof headlines: -wi oga federal govt don dey look di side of private-pipo to con put dia money ontop road build-build-mata for inside wi contri -dos wey get shikini and medium size business don enjoy one chop-tok wey de do to take teach-dem about how to take make dia business-dem succeed -di oga-madam kpata-kpata for germany don tell di govt of russia say make dem respect one agreement like dat wey de sign -wi naija football federation don draw carpet comot from di leg of wi super eagle coach -one naija fm ogbonge presenter and musician go soon mark her ten years ontop music stage ogbonge news 7:30pm naijafm 102.7 thursday 16th october 2014.by prof ‘’de say, one finger, no dey fit catch lice comot from head’’ Wi oga presido, Goodluck Jonathan, don tok say, ein don see-am say, only govt no fit solve all di problem dem wey wi contri-pipo-dem get. e say, dat na why ? disein govt decide to open ein hand walaka to welcome wi private-sector-pipo plus wi civil society-pipo-dem to helep support and shook-leg inside some serious area of mata-dem, inside wi contri Oga Jona, yan dis word, inside where ein dey inaugurate one empowerment fund, wey de call, Elumelu Nigeria Empowerment Fund, inside ein kaban for Abuja, today. E con point hand to di example of di Ebola disease wey all wi naija-pipo gada hand fight, and e comot from ground one-time. Oga Jona, wey squeeze face describe di way wey some bad-belle-pipo just take dey use di success story take dey play politik-now, e say, make no state governor tabi president, no take di glory for ein sef, b’cos na every body join hand fight di fight. ---------------------------------------------------------------------------------------- ‘’de say, na b’cos every lizard dey take ein belle face ground, dat na why, person no dey know, di one wey get stomach problem-o’’ Wi contri oga ontop work-work-mata, Mr. Mike Onolememen, don complain say, e no dey good at-all-at-all to dey scratch body-first, before wi see money to take dey build road-dem, inside wi contri. E say, dat na why, wi oga federal govt don dey look to di direction of private-pipo-dem, wey get money, to tok to dem to con put dia money ontop wi road build-build-mata. Oga Onolememen, yan dis word inside di national council meeting ontop work-work-mata, wey dey go on now for Asaba, inside Delta state yonda. E say, na about N1.8 trillion, wi oga federal govt dey spend to maintain and build road-dem alone inside wi contri every year. E say, even plus dis level of plenty money wey wi oga federal govt dey spend ontop di road-dem-so, e no dey enuf to protect di road-dem, wey e bi say, na heavy-heavy load-dem wey wi transport company-dem dey carry, na-im dey spoil 90% of di road-dem. E say, wi oga federal govt don arrange plenty plan-dem wey de won take fyn money to take dey maintain wi road-dem, and among di plan-dem, bi say? na how dem go re-build toll gate-dem plus weighbridge-dem put for wi federal highway road-dem, inside wi contri-naija. ---------------------------------------------------------------------------------------- ‘’de say, na wetin person plan sleep and wake up with, e ey use take work di following day-o’’ As part of ein plan-dem to make sure say transport-mata inside wi contri waka mini-mini sion-sion and tranga chiim, wi contri oga ontop transport-mata, Sen. Idris Umar, don announce say, wi oga federal govt won build railiway road wey go connect some 10 state-dem wey dey along wi contri waterside area-dem. Oga Umar, wey katapot dis informate today for Abuja, e say, di railiway go waka from Lagos-yee, pass thru Shagamu, Ijebu –Ode, Benin city, Sapele, Warri, Yenagoa, Port Harcourt, Uyo go end for Calabar. Wi newtory-person for Abuja, Raliat Adenekan, con katapot report say, wi oga federal govt don also give out di contract to dredge River Benue and complete some of di deep sea port-dem for wi contri. According to wi contri oga ontop informate-mata, wey won soon comot, Mr. Labaran Maku, wey follo yan inside di place, e say, correct transport-mata na one of di most importankpa things-dem, wey wi need for dis contri, as e also take salot sampaper di body of wi oga presido, Goodluck Jonathan, ontop dis ein transformation agenda wey ein dey do ontop transport-mata for wi contri, wey make wi transport system wey bin nogere for di past years, don con wake-up again tranga jim-jim. cue in: labaran) ---------------------------------------------------------------------------------------- ‘’de say, anybody wey ready to use food to take entertain ein family-member-dem, must ready to near fire-o’’ Wi senate today, don tell dia join-join committee-dem ontop money and appropriation-mata, say, make dem start work kia-kia ontop how to take panel beat within two weeks, di medium term expenditure framework and fiscal strategy paper, wey wi oga presido, Goodluck Jonathan, don katapot con meet-dem. Wi senate presido, Sen. David Mark, con tell di committee say, if dem quick finish work ontop dis first paper, e go dey easy for dem as senate to pass di 2015 budget wey dem dey expect to land dia domot any time from now. According to dis mid-term document wey dey dia hand-now, wi oga federal govt propose to spend N1.22 trillion as fuel subsidy money from inside di N4.817.76 trillion wey bi di total budget money for wi contri for di year 2015. Dis money include N971.4 billion, wey dem won spend to take support subsidy ontop petrol and N250 billion wey dem go spend ontop kerosene. Wi oga federal don also arrange say, na total of N7.286.89 trillion, dem go gada as money wey de go sell from wi oil and gas for di year 2015, with about N3.716 trillion, wey de dey expect from crude oil alone. Dos wey use dia eye look di document proper-proper, don tok say, de see say, na, N1.029 trillion, na-im wi oga federal govt won carry give ein ministry-dem, department plus govt agency-dem, to take build dia ogbonge project-dem during dat year. ---------------------------------------------------------------------------------------- ‘’de say, woman wey carry nine-month old belle, she no dey fit dey hide-am-o’’ Wi house of Rep, don confam say, dat report wey wi national constitutional conference gada during dat dia kak wey dem kak, wey end on August 4, dis year, e don reach dia hand. De yan say, na di total of di 360 member-dem of di house na dem don get di copy of report, for dem to use dia eye plus brain take look-am proper- proper. De say, though di way, wey di report take come meet dem-now, e neva wear any faze-cap as executive bill, b’cos wi oga presido, Goodluck Jonathan, neva present-am to di national assembly by ein-sef, for dem to begin take action ontop-am. Di tok-tok-person for di house, Mr. Zakari Mohammed, wey confam dis tory give us, e say di version of di report wey don reach dia hand, na di join-join version, wey gada some mata-dem, wey wi oga federal govt want say, make di house take note of wey dem go arrange into law, na-im de don see. Oga Mohammed, yan dis word just after 24 hours wey di house take confam say, na some 70 new area-dem inside wi contri 1999 law-book. dem don pass put for law ----------------------------------------------------------------------------------------
Posted on: Thu, 16 Oct 2014 20:04:28 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015