wow.... cool morning! Some ladies shaa. They go know wetin dem - TopicsExpress



          

wow.... cool morning! Some ladies shaa. They go know wetin dem want and yet when dat stuff come for dem, they go lyk tink about am 4 centuries. Imagine say one sista wey bin dey eye me for one function lyk dat, as i notice am, i come make some moves. Kam sachaa ya isi (wit soap and clean water), waiting 4 an answer, d next tin i hear be erm.... bros, abeg i nid some tym 2 tink abt it. Haba!! Even one sista wey bin dey disturb my cousin say she gbadu me eh, as i meet am, d same tin. Dis is more serious. My own be say make my woman no come altar fall my hand. Especially dat tym wey dem go say #pointing_at_me Do u take dis man as ur hus.b for better for worse, in riches and in wealth, in d morning and in d afternoon, in dry and rainy seasons, till death do u part?. My own fear be say make she no come yarn...... er... erm.... errm, lemme think about it. Shuo! Woman, na like dat u wan spoil my day, abi dem send u? I go jus nack am undertaker smackdown for there. What am i even saying? #yawns Aguu ajoka! Good morning pals!!
Posted on: Sat, 22 Nov 2014 08:02:59 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015