~:-)Strictly EBSU~:-).>:OM.C ...D>:O ..I miss presco campus wia - TopicsExpress



          

~:-)Strictly EBSU~:-).>:OM.C ...D>:O ..I miss presco campus wia medical students they read frm mornin to night yet 60% of them will fail and fail outI miss VGC hostel wia girls wey dey form as if na dia father get ebonyi state dey stay and boys wey no sabi anytin and dem dey claim big boys & sort dia courses,I miss medical centre wia boy dey enta chop beta OKPA 100 and belle full & girls go dey form buy 1plate of small rice wit head of fish 300...lol miss chi boy shop wia bad boys the go drink beer witout money & deposit dia phone,I dey miss G hostel wey big like one community,I miss those estate police men..if they catch u by past 10pm, sorry is ur name,I dey miss NURSING students...very short,very beautiful,very dumb & if they catch u on bed,oh my God,I dey miss Diamond bank for cas campus wia the whole students dey pay for text book..u fit com throughout d week & u never pay, then u go no say na EBSU u dey,I dey miss Med lab Faculty,d only faculty wey no resemble ETF building,I dey miss those ishieke boys wey go beat ¥ọ̥Ʊ wit dia bad mouth and shieke babes wey nor dey form like presco babes,I dey miss shalom hostel wey b like palmwine joint, becareful hostel wey all d babes dey jealous dia self, ajanwanchukwu hostel wey like general hospital, prestige hostel wey dem dey date dia self, galaxy hostel wey corpers dey base pass, analworld hostel d biggest and dirty hostel, golden paradise hostel wey b like ishieke prison, and my lovely hostel MODERN CITY wey dey b like 1 family and 4 nyt dey do rum 2 rum prayers, I D̶̲̥̅̊ε̲̣̣̣̥γ̲̣ ̣̥ miss emchuks hostel wey gels reach 50 boiz na onli 5,collect ur fone even ask 4 Charger. I dey miss havana bar wey sum guysss dey fear 2 go drink, I dey miss chika shop wey stuudent dey buy credit, I dey miss PRINCE & PRINCESS bar wey ishieke guy dey form big boy wit #1500, i dey miss PRINCE & PRINCESS hostel wia u go see warms for born hole, no gateman yet the house rent is still costly,I dey miss onye oma shop wia we dey go eat that dia abakaliki rice,1 full plate #100 with fat fish.lolOh I miss my medical students girls wey dey 4om say dem no dey shit but na dem shit pass.I miss those boys wey dey collect 50# from keke drivers for presco juntionI miss COMPTON hostel wia everybdy no knw who be visitor & hostel Member.I dey miss the best lecture hall in d world wia u can see 1000students in a small lecture hall known as CO1 and CO2.I dey miss MICROBIOLOGY deptment wia u can see 400girls and 20boys,I dey miss Presco pitch where everybody dey 4om premiership yet only few sabi trap ball.I miss presco Lecturers wey sabi tear lie 4 Africa shaa:O..I miss Ebsu die..plz add ur Own..
Posted on: Thu, 17 Oct 2013 06:31:19 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015