(1.)U collect babe number u use "chick" store am .shey e mama na - TopicsExpress



          

(1.)U collect babe number u use "chick" store am .shey e mama na fowl? (2.)U buy suya, ur woman com chop all the meat finish u com dey smile dey chop the onion. u be vegetarian? (3.)u dey wit ur guy & u dey receiv diff kinds of phone cals in 5min, yet u dey claim say u no dey cheat on ur guy. My sista, u be mtn customer care agent? (4.)You ask a girl for what she wants, she tells you money and you are angry . Were you expecting her to say wisdom and understanding? (5.)u wear blue skirt,green trousers,yellow cap. You carry red bag,white speck.u b rainbow? (6.)Ur mates pay complete fare, sit down comfortably 4 bus, u pay half dey stand & smile. Bros u b usher? (7.)ur girlfrnd dumps u for a rich man, u say she b gold diga but ur sister do dsame to anoda guy, u giv testimony for Church, sey na grace of God. Bros park well. (8.)Since last 2 weeks, PHCN never remember ur street & una no get common Tiger gen, yet u come my house still dey borrow Jackie Chan film from me.bros na PHCN office u wan go watch am? (9.)Ur babe get F9 parallel for Waec, she still dey ask for Brazilian Hair of #150.000 . Were she wan fix am?, ontop that coconut head? Comment wit d no u lik most
Posted on: Mon, 17 Jun 2013 09:30:52 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015