95.1 WAZOBIA FM LAGOS.Na CHIBOI de number one bus conducteor dey - TopicsExpress



          

95.1 WAZOBIA FM LAGOS.Na CHIBOI de number one bus conducteor dey inside studio ontop WEEKEND PARIPA.Abeg make una hear dis tori.E get one bobo wey be medical doctor,him friend say e go carry de babe wey e wan marry come show am.As de couple come him come see say na one of him HIV patients be de bebe wey him guy wan marry !! Now e dey confused whether to tell him friend say de girl dey HIV positive or not becos as a doctor,ya patient sickness na secret wey you no suppose expose or you go loose ya job for amebor.But if him keep quiet,him friend go catch HIV.So,if na you wetin you go do? You go talk ?
Posted on: Sun, 09 Jun 2013 19:13:21 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015