9JA HOW UNA SEE AM: - Today we dey chuk eye for the construction - TopicsExpress



          

9JA HOW UNA SEE AM: - Today we dey chuk eye for the construction of Pedestrian Bridges for inside Abuja town. Because just yesterday, Motor kill one lady wey close from work along Setraco/Mabushi/Kado express way as she dey try to cross road and the driver no wait, him run. We remember say Abuja Gov’t bin give contracts say make dem construct Pedestrian Bridge (Foot Bridge) for some areas for Abuja but e be like say the work don slow down now and e be like say no be all the areas wey the bridge suppose dey dem give the contract. And some areas wey don even get the bridge, piple no dey like to use am. Now ontop this one, wetin you think say both the drivers, piple wey dey waka for road, gov’t and everybody wey dey use road suppose to do to avoid this kind misfortune for Abuja roads? LadyG (@ladygdgenius) and Oche DKing (@ochewazobia) dey in da hausss #KuleleZone #9jaHowUnaSeeAm Twitter: @WazobiaFMAbuja Tel: 094-600-995 wazobiafm/abuja995
Posted on: Tue, 12 Nov 2013 14:19:19 +0000

Trending Topics



>
Our History [Hope never to be forgotten] The bombing of MacDonald
In 2 Corinthians 8, Paul talked about how the churches in
DUH!! Tree turned to cinders in Milbourne wasp drama 2:00pm
This just in... Flat stable & Optimus are finished visiting with

Recently Viewed Topics




© 2015