AND A GREAT GUY AND PASTOR AND FRIEND HAS A BIRTHDAY Utieyin Eyen - TopicsExpress



          

AND A GREAT GUY AND PASTOR AND FRIEND HAS A BIRTHDAY Utieyin Eyen Edema My first real memory of Utieyin aka Pastor Timothy was when I went to see Edema Eyen Amaluv his elder brother at their house in Ugbeyiyi and NEPA men came to cut their light. and Utieyin and Amaju decided to stop these NEPA guys as they were sure their dad who of course is a retired Chevron worker with more than enough money for his retirement and then some...and then some more. Wait, this gist no go sweet with English. These NEPA guys, unto the area them dey go cut light, them sef hold their side. Na one kine iron the main tall fit guy hold. Na so this Utieyin and Amaju begin push their ladder come down. Na so I dey look say I want fight for old age? Amaju no go fit start fight make me no join am unto many things. I no go fit dey there make these guys dey fight. AND I NO LIKE TO FIGHT and the NEPA guys hold tools and na Amaju and Utieyin dey disturb people wey dey do their work cos them tell people say if u done pay lightbill, paste your bill near meter and them get big generator. In fact, Tsewo Edema-eyen wey be my classmate and friend, him as an over-achiever, he fit call the NEPA oga and na sir sir sir e go answer the brilliant barrister. YES OH, if you no know, Tsewo na one of the quietest most influential people for Delta state. If you like dey use Okotie-Eboh an Ugbeyiyi and Ekpoma eye dey look am. God done do Tsewo own ....over do Tsewo own. So why these his junior ones want put me for fight for old age? The way I take hold that fight that day eh. I TRY. This Utieyin get better power. He go say bros bros push me go corner but I grip am and na so the NEPA guy with his igbo eye hold the iron dey wait for us. I dey sweat dey hold fight, how I go do if the fight start? That day, I beg God ....I BEG GOD make e let that fight pass over me and God do am. So na with pleasant surprise I see Utieyin for Maryland for US as he come take me out two years ago on my birthday. I come find out say Edema Jolomi junior brother wey want let me fight done dey called to be Pastor at OVERCOMERS CHURCH WORLDWIDE. I say na so me rush go the Ordination and Omas Atakere-Uadiale naim even cook the food. As them dey ordain am dey use oil bath all him head and body, I tell myself say what if Utieyin rush that NEPA guy and he use the iron hit him head. No be die the boy for die? How he for take be University of Maryland trained Engineer? How he for take dey do him masters degree now and still be servant of God? NO BE YEYE TEMPTATION DEVIL BEEN DONE SET DOWN THAT DAY????? Just last month, this boy carry money buy many clothes and books put for containers carry go dash Sapele people. He say FAITH WITHOUT WORKS IS DEAD. I EMPTY MY ACCOUNT BUY THESE THINGS TAKE GO SHOW CHRIST LOVE FOR HIM CHILDREN. NO BE ONLY PRAYER I GO PRAY FOR THEM. THE ONE GOD PUT FOR MY HAND, BROS, I SAY MAKE I BLESS THEM TOO. AS I COME BACK SO, THE ONE WEY WEAR POLO WEY I BUY GIVE AM GO SAY THIS IS WHAT A MAN OF GOD GAVE ME So na with joy me take follow am go church today and also personally dey ensure say today we give the giver, we care for the carer and we pray for the prayer....for the one who prays. So Omere mi. Pastor, younger brother, Sapele boy, MArylander, American resident. I pray that God steadies your feet in his path. I pray that you find a good wife that will ensure you reach your full potentials in Christ and in Society. It is well with you Pastor Timothy. Happy Birthday.
Posted on: Sun, 27 Jul 2014 18:49:50 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015