Abeg make u no laugh, I just need una advise! My Blackberry - TopicsExpress



          

Abeg make u no laugh, I just need una advise! My Blackberry chop my money tire, so tey I come vex go sell am come take some money out of the money I take sell come buy new China phone! Hhmm!!! I don land for bigger palava o! Make una help me see that features wey this new China come get: 1. E go full after 3 minutes of charging. 2. The phone na touchscreen, e get TV, Flashlight, Nail cutter, Fire lighter etc. 3. I fit write text message with toothpick sef. 4. The spelling get mistakes e.g NokLa, blackderry, i-pon, samswag, somny election, apblo etc. 5. When aeroplane pass, e go record One missed Call. 6. When a big car horn, e go show Charger connected. 7. If person shout near me, e go show Message Received. 8. When Chinese man pass, e go show, One Bluetooth device found. 9. When fine person waka pass, e go show, WiFi On. 10. When ugly person waka pass, e go show, Virus detected. Abeg I wan sell am! Who wan buy ooo? Even as I dey find buyer now sef, e dey show me for screen say, No contact found.
Posted on: Wed, 27 Aug 2014 10:25:06 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015