Akpos ran to father with happiness. Akpors :- Papa papa papa - TopicsExpress



          

Akpos ran to father with happiness. Akpors :- Papa papa papa See my result, Na me carry 3rd. Papa Akpors :- Hahahaha, Akpors Akpors! Na now I know say na me born you. Akpors :- Shey I tell you na. All those time I dey carry 35th..Na the teachers dey do ojoro, They know say I too brilliant. Papa Akpors :- I believe you my boy. Na now I fit buy that Bicycle wey you see for Papa Metus shop! Akpors :- Papa na u biko. You get mouth pass BasketMouth. Papa Akpors :- but, Who be the two idiots wey pass u sef Akpors? Akpors :- Na one WIZARD wey be Isaac and one WITCH wey be Patience. Papa Akpors :- No mind them, You go show them next term. But who you come pass na? I no say dem plenty and you no fit mention all of them, I just wan know how many of una dey class. Akpors :-Na just the three of us I don mention so na… Isaac, Patience and Me. Na just the three of us PRINCIPAL put for Elementary Class ‘F’ !!! Na im Akpors papa just land for floor, gboossa, faint o!!! Hsahahahahahahah una good night o
Posted on: Thu, 16 Jan 2014 20:19:00 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015