Chelsea bilala West Brom as dem continue to gap all man ontop - TopicsExpress



          

Chelsea bilala West Brom as dem continue to gap all man ontop Premier League table on Saturday, as Manchester City dey shadow dem and Manchester United show say dia market still fit sell. Chelsea futbal na kwench, as dem waya West Brom 2-kondo for Stamford Bridge (Chelsea stadium). Na Diego Costa and Eden Hazard score de two goal, meaning say Chelsea neva troway any match, out of de 18 wey dem don play dis season. City come from back, chook hand for Swansea eye, nack dem 2-1 for Etihad Stadium (City house), as Yaya Toure score dia second goal. Meanwilly, Manchester United neva fit get diasef since Louis Van Gaal colet de coachi work, but dem still waya Arsenal 2-1, to climb enta fourth position ontop league table. Dat na de fes time United don win away match dis season. Since 1996, Arsenal dey always finish season for top four, but na eight position dem tanda now, as na onli 17 point dem don manage gada. De las time e bad like dis don reach 32 years now. Chelsea dey gap all man wit 32 point, for de 12 match wey dem don tap, and Southampton dey shadow dem for second position, as dem don gada 25 point out of de 11 match wey dem don tap now. Dem go follow Aston Villa play on Monday nite. City don gada 24 point and United colet 19 point, but na onli goal dem take gap Newcastle, even tho dem bracket diasef. Newcastle tanda for fifth position now, afta dem waya bottom club, QPR 1- kondo. IGWE DEY WAIT DEM Even tho 26 match still remain for dis season, Chelsea resembu new igwe afta dem play West Brom like small pikin. West Brom bin don dey chop two goal wen refree dash dia defenda, Claudio Yakob red card, sake of say hin carri two leg mark Diego Costa. Afta hin team colet six win for de six match wey dem don tap for house dis season, Chelsea coachi, Jose Mourinho yarn amebo television, Sky Sports, say: We play ogbanje futbal for fes haf. For dat same London, for match wey hapun for evening, United no tap beta ball at all, but dem still manage waya Arsenal for house, place wey Arsenal neva troway any match since de fes game las season. Arsenal bin see many chance to bilala United but troway all of dem, come chop fes goal as match reach 56 minit, wen Kieran Gibbs carri leg, nack ball enta hin own net. Crayfish come bend for Arsenal as dia goalie, Wojciech Szczesny come wound hinsef join, come waka comot match. Arsenal come carri Emiliano Martinez enta post, but hin no fit do anytin as Rooney score United second goal wit coret counter, wen match reach 85 minit. Rooney bin play hin numba 100 match for England, wen dem bin follow Slovenia play las Saturday, come score hin goal numba 46, wen dem bin follow Scotland play on Tuesday. Arsenal show diasef small, afta Olivier Giroud, wey neva tap ball for de las three mont, bicos of wound, enta, score one helele goal from outside 18, but all na June 12, as United still win match. United coachi, Van Gaal, yarn amebo pipu, BBC, say: Dis win too pure now. We get many playa wey carri wound, but we still win dis kin hard match. I fit laff now, but if to say dem score one, out of de five chance wey dem see for fes haf, tori for difrent. Arsenal coachi, Arsene Wenger, say: Na we play dem pieces, but na we troway match. Notin we fit do. I know say pipu go cuss us, but we try. West Ham bin tanda for fourth position bifor match start, but finish for six position, afta Everton waya dem 2-1. Na Leon Osman score winning goal for Everton (de guyman don tap 400 match for dem now) as Everton neva troway any match out of dia las seven. For de oda match dem, Burnley waya Stoke 2-1, as Danny Ings score two tines inside two minit, for fes haf, and Leicester City, wey neva fit score goal for five league match now, follow Sunderland play 0-0 draw
Posted on: Sun, 23 Nov 2014 16:30:08 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015