Conversation between a Rat and Man(Frank) Rat: (with tiny voice): - TopicsExpress



          

Conversation between a Rat and Man(Frank) Rat: (with tiny voice): hello. Frank: hello, who am i speaking with? Rat: na Mr Frank be dis abi? Frank: yes u are speaking with Mr Frank, who is dis pls? Rat: so u no recognize my voice abi? Na me your room mate. Frank: u say what?. Rat: ur room mate Rat. I dey ur room now.. Frank: i beg ur pardon! Rat: which yeye beg u dey beg. I never chop since yesterday wey u waka comot. I check that place wey u dey put food i no see anything. I check d kitchen nothing. I even check your fridge no single food there. E be like say u wan kili me abi.. No problem, i jux say make i let u know say that ur certificate 4 inside your wardrobe wey dem write CAPE COAST UNIVERSITY. I don eat d "C" comot. Remaining "APE" COAST UNIVERSITY. Let me see which work u go take "APE" COAST university find....(rat ends call)
Posted on: Sat, 10 Aug 2013 14:39:40 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015