Dis Sunday na Sunday wey Tottenham Hotspur no go forget soon - TopicsExpress



          

Dis Sunday na Sunday wey Tottenham Hotspur no go forget soon as West Ham kobalize dem badly come na dem serious akpako for White Hart Lane. Nobodi for bilif wetin hapin for de match, as all men dey tink say na Spurs go win becos of all de ogbonge players wey dem buy, plus say West Ham sef no dey form at all, but everi everi come change as West Ham do action feem, waya dem 3-kondo. Afta Spurs bin dominate finish for de fes haf but dem no fit score, de secon haf sef come be real drama as West Ham do de original wayo to beat dem. Na defenda Wiston Reid score de fes goal from kona kik wey dem get for de 66 minute. Wahala come pack plenti for Spurs as West Ham come do dem shege for de 72 minut as Ricardo Vaz Te find space shot ball wey Spurs Kipa Hugo Lloris blok but de ball come hit Vaz Te enta net for de Hammers second gol. As Spurs come dey do gra gra to find gol, West Ham sef come use dat one take finish de match wit de numba three gol as Ravel Morrison carri ball from hin won haf, dribul pas Vertonghen and Dawson ,bifor hin chip am pass Lloris for de 79 minute, to gif West Ham dia fes win for Spurs side since 1994. Chelsea show beta head to take hol Norwich bifor dem waya dem 3-1 for Norwich bakyad as Jose Mourinho as hin boys dey jolly go bak for London. Na Brazil midfielder Oscar fes score for de blues for de 4th minut. as match just start but Norwich come equalise for de 68 minut through Anthony Pilkington. Jose Mourinho come play small cha cha, put Eden Hazard and Wilian for de secon haf and na de two of dem come score de gols wey helep de London team win de match. Two sharp sharp gol for de 85 and 86 minut come chuk Chelsea for front and na so de match take finish, as Chelsea go hapi wit de three points wey dem don get so. Arsenal don climb back go on top Leahue table as per say dem score gols pass Liverpool afta dem draw 1-1 wit West Bromwich Albion. De game hard de gunnas no be small and as West Brom come score for 42 minut, e come be like say Arsenal rekod for away wins don pafuka be dat. Claudio Yacoub score for dem but as match dey go Jack Wilshere come waya fin shot for de 63 minute to equalise for de gunnas. Na so de two team jus dey enta each oda, but none of dem bin fit score as de match finish for draw. Southampton kukuma do Swansea shege as dem waya de League Cup defendin champion 2-0 for dia own match wey dem play on Sunday. Adam Lllana open gate for de 19 minute for de fes haf and Jay Rodriguez come jam de door for mortuari time for de 83 rd as Mauricio Pochetinno and hin boys go celebrate dia ogbonge win Na de full results for Sunday matches be dis: Norwich 1 Chelsea 3 Southampton 2 Swansea 0 West Bromwich Albion 1 Arsenal 1 Tottenham Hotspurs 0 West Ham 3
Posted on: Mon, 07 Oct 2013 06:26:00 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015