E get one particular restaurant wey i dey chop 4 GRA, E get - TopicsExpress



          

E get one particular restaurant wey i dey chop 4 GRA, E get one oyibo wey dey always come chop there too... Any tym dis oyibo chop finish he go shout ' Hey', so I wonder wetin dey make am shout, i decide to chop wetin d oyibo dey always chop so maybe me self go shout too.. i reach d restaurant last wk friday, i order wetin d man dey chop.. Dem tell me say na chicken & red wine, so i chop am, but I no shout, i colet xtra plate, but i stil no shout.. na then i just vex ask 4 my bill. D waiter tell me say one plate of chicken & red wine na N75,000 then d xtra plate na another N75,000....na then I shout Heyyyyyy! Heyyyy!! Heyyyy!!! Heyyyyyyyyyyyyy y!!!!,I still dey shout till now..
Posted on: Fri, 02 Aug 2013 12:29:05 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015